Mokwa
Mokwa na one Lokal Govamet Aria wey de Niger Stet, Naija. Di hed-kwutas of Mokwa na Mokwa town wey de on di A1 Hi-way of di west of do Aria. Di pipo wey dey live inside Mokwa town go rish 244,937 (dis na wetin dey tok in 2006) . For di souta part of Mokwa, na Niger riva pesin go see. From di West of di Lokal Govamet, pesin go see Lake Jebba an also Kaduna Riva dey di East side. Kwara Stet an Kogi Stet de nia Mokwa LGA. Di A1 Hi-way Kross di Niger for Gana go rish Jebba wey de Kwara Stet. Mokwa na one of di Nupe Kindom wey di Ndalile dey kontro (Now, na Lile Shaba Aliyu dey kontro Mokwa now). Some of di ward wey de Mokwa na:
- Muwo
- Bokani
- Kudu
- Kpati
- Jebba
- Rabba
- Ja'agi
an odas . Mokwa town get emir wey de do as dia king or oba. Di nem wey dem dey kol dia emir or oba for Mokwa na Ndalile. Di total Aria of Mokwa na: 4,338Km² an di sensor wey dem do for 2006 show sey na 244,937
=Weyda kondishon of di pless
[chenj-am | chenj-am for orijin]Di tempireshon of Mokwa town dey kom an go dorin a hol year. Di tempireshon na bitwin 63°F to 98°F. Di tempireshon fit go down to 57°F an e fit go up to 103°F Dorin dia hot sisin wey dey hapun from February 3 to April 26, di tempireshon dey pass 95°F. an e dey last for 2.7 month. For Mokwa, na di month of April dey hot pass bikos di tempireshon dey rish 96°F an di tempireshon dey low rish 77°F. Di Kool sisin for Mokwa dey last for 3.3 month an dis one dey start from July 1 go rish October 11 . Dis tempireshon for evri-day for dis month dey havirej 87°F an di havirej smol tempireshon dey rish 64°F. Na December month dey Kool pass for Mokwa