Jump to content

Mojisola Meranda

From Wikipedia
Mojisola Meranda
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromNaija Chenj-am
Wok wey e dey dupolitician Chenj-am

Mojisola Lasbat Meranda (wey dem bon for 16 August 1980) na Naija politishan an di niu spika of Lagos Stet Hauz of Assembli. Sins June 2015, na shi dey stan for Apapa Konsistuenci. Dem selet am as spika on 13 January 2024 an na bikos dem tok sey di bifor bifor Spika Mudashiru Obasa no uze im ofis wel an sey e du som magomago on top moni for ofis.

Meranda go Lagos Anglican Girls Grammar School (1992-1996) an Ansar-Ud-Deen Secondary School (1996 -1998). Na shi bi di Library Prefect an secretary of di press club wen shi dey sekondari skul.

Dem bon Meranda on 16 August 1980, to di famili of Ojora of Legos, T. A Lawal Akapo an Princess M. A. Lawal-Akapo of du royal families of Ojora, Aromire, Onitana, Oloto, and Oniru. Shi get broda wey bi Oniru of Iru Land, Oba AbdulWasiu Omogbolahan Lawal.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Mojisola Meranda: Enter Lagos First Female Speaker". Daily Trust Newspaper, 13 January 2025, Retrived 14 January 2025.

2. 10 astonishing facts about first female Lagos Assembly Speaker. 13 January 2025, PM Newspaper.