Mohammed Badaru Abubakar
| Man abi wuman | man |
|---|---|
| Kontri wey e kom from | Naija |
| Nem for lokal langwej | Mohammed Badaru Abubakar |
| Orijina nem | Mohammed Badaru Abubakar |
| Fest nem | محمد |
| Wen dem bon am | 29 September 1962 |
| Ples wey dem bon am | Babura |
| Fest langwej | Hausa langwej |
| Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Hausa langwej, Naijá langwej |
| Langwej wey e tek rait di wok | English langwej |
| Wok wey e dey du | politician, business executive |
| Post wey e dey | Governor of Jigawa State, Minister of Defence of Nigeria |
| Party wey e dey for politis | All Progressives Congress |
| E pipul | Hausa pipul |
| Hair kolor | black hair |
| Eye kolor | brown |
| Personal pronoun | L485 |
Mohammed Badaru Abubakar (dem bon am 19 September 1962) na Naija forma minista of defense from 21 August 2023 go rish 1 December 2025. Badaru risain bikos of im bodi no too dey strong to kontinu di work. E bi forma gofnor of Jigawa Stet from 2015 go rish 2023. Badaru na bifor bifor oga for Naija Presidenta komitee wey dey tekia of how fertilizer go tell rish farma hand. Na im stil bi di oga of di presidental komitee wey dey tekia of how moni wey no kom from oil go tek rish govamet hand. Badaru bi di fonda of Talamiz Group
How im tek go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Badaru go Ahmadu Bello Yunivasiti wey de Zaria go rid Akauntin. E kolet im Akantin Digree from di Yunivasiti. Wen e dey di Yunivasiti, Badaru join di komuniti hativiti, e put bodi for di Yunivasiti sport an bizness for di skul. Badaru bi one of di old-skul studet of NIPSS (National Institute of Policy and Strategic Studies).
How im tek work
[chenj-am | chenj-am for orijin]Afta Badaru finish Yunivasiti, Badaru start im bizness, di Talamiz Group. Talamiz Group na one big kopini wey dey do bizness for motor, dey mek tins, de inside hagrikolsho, an de inside tekin kia of hanima. Talamiz Group stil dey inside to dey kari goods from one aria to anoda.
How im tek put bodi for politis
[chenj-am | chenj-am for orijin]Badaru na forma vais-shaman of di "Federation of the West Africa Chamber of Commerce and Industries". Badaru stil bi memba of "Association of National Accountants of Nigeria". Bifor e bikom memba of Akauntat of Naija, e bi memba of "National Council on Privatisation".