Jump to content

Michael Kayode

From Wikipedia
Michael Kayode
pesin
Man abi wumanman Chenj-am
Kontri wey e kom fromItaly Chenj-am
Country for sportItaly Chenj-am
Nem for lokal langwejMichael Kayode Chenj-am
Orijina nemMichael Olabode Kayode Chenj-am
Fest nemMichael Chenj-am
Famili nemKayode Chenj-am
Wen dem bon am10 July 2004 Chenj-am
Ples wey dem bon amBorgomanero Chenj-am
Fest langwejItalian Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokItalian Chenj-am
Wok wey e dey duassociation football player Chenj-am
Sportassociation football Chenj-am

Michael Olabode Kayode (wey dem bon for 10 July 2004) na Italian profeshonal futbol playa eey dey play right-bak for Brentford futbol klub. Di klub de Premiha Ligi in England.

How im tek start life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Kayode peret kom from Naija but na Italy dem bon am.

How im tek play futbol

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Gozzano

Kayode wey bi yoruba start I'm futbol karia wen e join Juventus junior futbol tim. E de di junior Tim for seven years ontil e komot dia in 2018. Kayode folo Serie D Klub Gozzano play di 2020-21 sisin. For dat sisin, Kayode get two goal an get two hasist in 34 game. Gozzano komot from Serie D ligi kom enta Serie C for dat sisin. Kayode tok sey e yuz di Serie D to fit move forward.

  • Fiorentina

Kayode komot from Gozzano enta Fiorentina junior futbol tim in 2021. Wen e dey Fiorentina junior tim, e helep dem win one Coppa Italia Primavera an one Supercoppa Italiana Primavera.

For 19 August 2023, Kayode play im fest Serie A game wen Fiorentina win Genoa 4-1 for Genoa ples. By di time wey di sisin wan finish, Kayode don dey play wel wel for Fiorentina fest tim an meni Europian futbol Tim dey chuk eye for am. Kayode de di Fiorentina tim wey rish di final of UEFA Conference Ligi.

  • Brentford

Brentford tok sey dem don boro Kayode on loan mek e kom play for dem till di end of 2024-25 sisin. Na on di 24 January 2025 dem tok dis one. Brentford stil tok sey dem fit buy Kayode at di end of di sisin. Finali Brentford sahin Kayode pamanet in May 2025. Na five years kontrat dem give am.

How im tek play for kontri

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For July 2023, Kayode goal wey hapun in di 19 minits for di 2023 UEFA European Onda-19 Shampion-ship mek Italy win Portugal an kari di kup.