Jump to content

Mary Njoku

From Wikipedia

Mary Remmy Njoku (dey bon am 20 March 1985) na Naija aktress, produsa an pesin wey sabi do smol smol fim for intanet. Njoku stil bi di fonda of di ROK TV Shannel an di Oga patapata of ROK Studios.

Na 2013 Njoku fom ROK Studios. ROK Studios get fims, TV program wey pesin fit dey luk for ova three thousand (3000) hours an dis one don mek ROK Studios di lidin produsa of fims wey famili go like to luk.

Njoku don wok to see sey im brand ROK don den popula with di fest shannel wey ROK get. Dia fest shannel start to wok on Sky in 2016 for UK. Leta, ROK enta DSTV. DSTV na one netwok wey dey show difren channel for Afrika kontri.

For April 2018, Njoku bring out two difren Pan Afrika Channel: ROK2 an ROK3. Di sem year, e bring out anoda Channel for pipo wey de live for Ghana an e kol dis Shannel: ROKGH.

For 2019, one French TV Canal+ buy ROK Studios from IROKO Partners an dat deal bi di deal wey big pass wey wan hapun for Sub-Saharan Afrika at dat time.

How im tek start life an go skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Amuwo Odofin wey dey Legos dem bon Mary Remmy Njoku. Njoku na di nomba six pikin of di eight pikin-dem wey e peret bon. E papa kom from Nsukka, in Enugu Stet.

Njoku go Amuwo Odofin Hi Skul, Nashonal Kolej Bagada, an Navy Town Sekodiri Skul. Njoku get Diploma satifiket in Komputa Sayens.

E enta Yunivasiti of Legos in orda to rid English Langwej. For 2012, Njoku go London Fim Akedemi wey de United Kingdom wia e tek one stodi in fim Prodonshon wey bi: Movie Majik Bojetin an Schedule. Na Njoku hosband give am di moni to go do dis korse. Na wen Njoku don dey smol na im e don like to dey akt stej aktin. In fat, wen e dey sekondiri skul, e dey akt skul-drama for dia.

Wen Njoku de 17 years, e join Nollywood indostrie in 2003. Njoku bilif sey edukeshon no bi di koko for pesin bot sey na wetin pesin fit do na im impotat pass.

How Njoku tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Njoku akt I'm fest fim for Nollywood in 2004. Di nem of di fim na: Home Sickness. Inside Home Sickness, Njoku join Chioma Chukwuka. Na Blackberry Babes wey dem do in 2011 mek Njoku popula wel wel. Bitwin 2011 an 2013, Njoku produs IROKtv, weybi YouTube platfom wey pipo fit luk selebriti intaviuw an some program . Dey mek am Shif Kontent Ofisa at IROKO Partners. Na dat year im fim Thy Will Be Done enta wold premier wey e do for BFI IMAX inside London. Thy Will be Done na di fest Nollywood fim wey dem wan luk an premier in IMAX

E pasonal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Njoku mari Jason Njoku on 18 August 2012. Di weddin hapun for Festac Town wey de Lagos. Jason Njoku na Naija bizness pesin wey dem bon for England. On 30 July 2013, Njoku an Jason im hosband welkom dia fest pikin kom life. Dem give di pikin di nem: Jason Obinna Njoku. Dia sekod pikin wey bi gel kom to dis life on 24 August 2015 an e nem na: Nwakaego Annabelle Njoku. Dia nomba three pikin wey e nem na: Amber Nnenna Njoku kom dis life on di 4 August 2017.

Fims-dem wey e de inside

[chenj-am | chenj-am for orijin]