Jump to content

Maria Bernadete Pacífico

From Wikipedia

Maria Bernadete Pacífico (dem bon am on 1951 – an e kpai on 17 August 2023), wey people sabi as Mãe Bernadete, na Brazilian wuman wey pesin wey dey lead tradishonal African-Brazilian religion, kommunity activist, politician, an leader for quilombo, place wey African people wey dem kari go Brazil as slave don turn to their own free kommunity. Shi bi leader for Pitanga dos Palmares quilombo, one settlement wey African pipu wey dem enslave first build for Simões Filho, Bahia, for Northeast Brazil.

For August 17, 2023, two men enta Bernadete hauz, shoot ha more dan 12 times for fez wen ha grandchudren dey luk. Shi bi coordinator for Brazil national council of quilombos (CONAQ) an bifor bifor Minister for Racial Equality for Simões Filho.

Sins 2017, dem don put ha nem for Brazil Human Rights Defenders Protection Program (HRDPP) bikos of bad pipu don dey threaten ha laif. Dis one stat afta dem kpai ha pikin, Flavio Gabriel Pacífico dos Santos, wey pipu sabi as Binho do Quilombo.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]