Jump to content

Mamlambo

From Wikipedia

Mamlambo na one goddesses wey South Afrika pipo dey woship an wey stil de di tradishonal tori of Zulu pipo. Mamlambo bi di goddess of Rivas an dem diskrib am as one kreashon wey wan risembu snake. For 1997, one South Afrika niuz-pepa (odas niuz-pepa like di one wey de Johannesburg wey bi The Star an di one wey de Cape Town wey bi Cape Argus) ripot sey di pipo wey dey live nia Mzintlava riva si one big hanima wey long rish about 20 meters (65.62 feet's). Mzintlava Rivas dey nia Mount Ayliff in South Afrika. Di pipo for Mount Ayliff tok sey apart of sey di hanima wey dem see inside di wota long wel wel, di hanima get di head of horse, e bodi na fish bodi, e get smol leg, an di hanima neck na snake . Di pipo stil tok sey dis big hanima dey shine green light for night. Bitwin January 1997 go rish April 1997, na about nine pipo dey bilif sey Mamlambo don kpai.

Wen polis pipo wan tok wetin hapun to dis nine pipo, dem sey all of dem dey inside wota an afta somtime krab kom chop some part of dis head an neck. But di vilejas tok sey na Mamlambo chop part of dis head an neck. Di vilejas bilif sey na so Mamlambo dey always do. Bikos of dis one, anoda nem wey dem dey tek kol Mamlambo is "Brain sucker. Felicity Wood rait inside one buk kol Extraordinary Khotso (2007) sey, Pipo dey bilif sey Mamlambo fit helep dem get moni an propatis wey oyinbo pipo dey get. Dis one mek dem dey pishon Mamlambo as oyinbo Mami Wata.

Na dis folorin risin mek pipo start to bilif in Mamlambo:Na bikos pipo don tire for tradishonal vilej life, how life no balance at all, how e dey sweet Afrika pipo to live dia life like oyinbo .

Jos like Mami wata imsef, Mamlambo sef fit give you pawa an moni. But wen Mamlambo vex, e fot skata evri-tin.