Mami Wata
Mami Wata, or Mammy Water or half wuman-half fish, wey some pipo stil sabi as Wota Spirit, na one goddess wey de di tradishonal tori wey pipo wey kom from west Afrika dey tok about. Pipo wey go skul wel wel tok sey di orijin of di tori start wen Oyinbo pipo kom west Afrika in di 15th senturi. Na di pikshon of oyinbo wey part of di emeji na half wuman-half fish start di tori for west Afrika Histri mek us no sey pipo start to dey emaji Mami wota from di fine fimeli wey kom from oyinbo land or land wey nia oyinbo land. In di midu of 19 senturi, Pipo bigin to dey yuz di pikshon of Nala Damajanti dey emaji how Mami wota go bi like. Nala Damajanti na one wuman wey sabi dans with snake wel wel. Dis wuman pikshon evun popula pass di fest emeji wey bi half wuman-half fish wey Afrika pipo fest bilif on. To sopot di mata sef, Indian pipo wey pratis Hindu sef mek Afrika pipo bilif in Mami wota. Dis Hindu woshipa get pikshon of wuman wey sabi play with snake.
In fat, bikos of one Hindu god wey e nem bi Hanuman, Afrika pipo start to dey bilif sey man Mami wota sef go de. Dey give Mami wota wey bi man anoda nem. Di nem na Papi Wota. In some Afrika kontri an land wey oyinbo kari Afrika pipo go as slave, Pipo dey woship Mami wota. Bikos of dis woshipin of Mami wota, Kristeniti an moslim pipo dey luk pipo wey dey woship Mami wota as pipo wey dey woship Devil. Mami wota tori don de meni TV an Redio tori an meni buk sef don rait tori about am.
How dem tek form di nem
[chenj-am | chenj-am for orijin]Di nem Mami wota kom from two English word, Mammy an Water. Di word Mami Wota wan risebu one word wey pipo of Sierra Leone dey yuz tok about am. Di word na mami wata. Di word mami wey de inside Mami wota kom from di English word wey mins mama. Mami wota no get pikin or famili memba. Di tori or pikshon of Mami wota wey pipo dey see dey show sey e no get eni famili memba. Mami wota dey always dey alone. Wen pipo dey tok about Mami wota, dem dey tok sey na forin wuman e bi. No Afrika kontri don Eva tok sey Mami wota kom from dia vilej or tribe
Di orijin of di tin
[chenj-am | chenj-am for orijin]Pipo wey go skul tok sey di orijin of Mami wota start wen Afrika pipo start to dey do tins with oyinbo pipo. Afrika pipo don dey see di pikshon wey oyinbo pipo dey kari about wey get Mami wota sins 1400s an 1500s. As we see am from wetin Henry John Drewel tok