Mama Qucha
Mama Oucha or wey pipo still sabi as Mama Cocha) na one oldin days Incan goddess wey dey kontro sea an fish. Na Mama Qucha pipo stil bilif sey dey protet pipo wey dey work for sea an pipo wey dey kach fish for wota (fisher-man). Mama Qucha bi di wife of Wiraqucha , na Mama Qucha bon Inti an Mama Killa. Pipo dey woship Mama Qucha bikos dey bilif sey e fit kontro di sea mek di sea no vex. Anoda risin wey pipo dey woship bi sey Mama Qucha fit helep fisha-man to kach plenti fish. Wen di Incan pipo wan tok about di four impotat goddess (modas) wey de, Mama Qucha de inside di four. Di oda three na:
- Pachamama
- Mama Nina, an
- Mama Wayra.
Togeda with Mama Quilla (di Moon) an Pachamama, Mama Qucha join dem to form di Incan Lunar Trinity. For di aria dem wey Incan pipo dey live; dey bilif sey Mama Qucha bi di mama of all wota, weda na rivas, lagoon, lake, or big wota like ocean or "Sea. Di Incan pipo stil bilif sey na Mama Qucha dey tekia of wota wey human-bein demsef dig for demsef (ezampul like well).