Jump to content

Mali

From Wikipedia

Mali, wey dem dey call am Republic of Mali for official mata, na kontri wey no get any ocean or sea wey dey touch am for West Africa. E na di eighth biggest kontri for Africa, with land wey cover pass 1,240,192 square kilometres. Di kontri share boundary with Algeria for north, Niger for east, Mauritania for northwest, Burkina Faso and Ivory Coast for south, and Guinea plus Senegal for west. As of 2024, Mali population dey around 23.29 million pipo, and almost half of dem (47.19%) no even reach 15 years old. Di capital and biggest city na Bamako. For langauge mata, Mali get 13 official languages, but Bambara na di one wey plenty pipo dey talk pass