Moving Robe Woman
Moving Robe Woman (Sioux name Tȟašína Máni), wey dem still kol Mary Crawler, Ha Eagle Robe, Shi woks wit Her Shawl, Walking Blanket Woman, Moves Robe Woman, wok wit Ha Robe, an Tashenamani, na one Hunkpapa Sioux wuman wey folo faight General George Custer for di Battle of Little Big Horn. Di reason wai shi faight na sey shi wan revenge her brother, One Hawk, wey dem don kill.
Hau shi stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Moving Robe Woman bon for area wey dem nau dey kol Grand River, wey dey for South Dakota. Ha papa nem na Crawler, but dem stil sabi am as Siohan. E be di chief for Hunkpapa people dem, an e stil follo for di battle wey dem fait. Her mama name na Sunflower Face.
Wen shi bi 17 years, shi folo war grup waka go Montana, go fait Crow pipu dem. Wen shi rish like 22 years, shi an ha famili kom pack go Peji Sla Wakapa — na di plez wey for English dem dey kol Little Big Horn.
Battle of Little Big Horn
[chenj-am | chenj-am for orijin]Wen shi bi 23 years, her papa an mama tel am sey ha broda don die — na Pehin Hanska (dat na wetin Lakota pipu dey call General Custer) and Custer soldiers dem kill am. Not too long after dat, Custer soldiers dem ride horse enter di big Lakota village wey dey near Greasy Grass River, kom stat to shoot gun.
Leta for di faight, one Oglala Lakota warrior wey dem dey kol Fast Eagle tok sey na him hold Custer hand, so dat Moving Robe Wuman fit stab am for bak. But plenti oda warriors tok sey na dem kil Custer, so e no clear who rili kil am. Pipul wey see Custer bodi after di faitt tok say na gun kil am, dem no tok anything about knife wound.
Moving Robe Woman still kill two of Custer men dem to take revenge for her brother. One she use knife, di other one she use revolver (small gun). Di second person wey she kill na one army interpreter wey dem dey call Isaiah Dorman.
==Later years After di Battle of Little ==Bighorn, she follow her people waka go Canada. She stay for there until 1881, before she come move go Kenel area for Standing Rock. For 1923, when she don reach 70 years, di Standing Rock Family Information Survey talk say she dey live alone for one small log house wey near Grand River for west of Bullhead, South Dakota. Dem still tok seyz shi get 18 horses and 23 cows.
Interview
[chenj-am | chenj-am for orijin]One man wey im nem bi Frank B. Zahn interview Moving Robe Woman for Fort Yates, North Dakota. Di interview dey for one book wey Richard G. Hardorff write, di buk nem na Lakota Recollections of theCuster Fight, New Sources of Indian-military History.
For di interview, shi tok how her body take do her wen shi hear sey ha brods die for Little Big Horn:
"My heart pain me well well. Revenge! Revenge! For my brother wey die. I think about my smallbrother, One Hawk. I run go bush wey near me, go carry black horse. I rub my face with red colour and I plait my black hair. I dey mourn. I be wuman, but fear no katch me."
Pisho an artwork
[chenj-am | chenj-am for orijin]One photographer wey dem call F.B. Fiske snap her picture wen she don old. Di pisho dey for National Anthropological Archives for Smithsonian Institution.
One American artist wey im nem bi Thom Ross even do 200-piece artwork about di battle, an one of di painting show Moving Robe Woman.