Lwa
| Subclass of | spirit |
|---|---|
| Rilijon | Haitian Vodou, Louisiana Voodoo |
| Worshipped by | Haitian Vodou, Louisiana Voodoo |
| Kontri | Haiti |
Lwa wey pipo sabi wel wel as Loa na spirit-dem wey de Afrika rilijion of Haitin Vodou. Dis spirit tori don evun enta some form of Louisiana Voodoo. Meni of dis Lwa tori get dia tori from di tradishonal rilijion wey de west Afrika. Di two mejo Afrika pipo wey di Afrika tori dey kom from na di Fon pipo an Yoruba pipo.
Inside Haitian Vodou tori, di Iwa na di spirit wey dey bitwin human-bein an Bondye. Bondye na di kre-a-tor or God. Pipo wey dia rilijion bi Vodou bilif sey di Iwa wey de dis wold pasd one thousand. Dis Vodou woshipa bilif sey dia nem of Iwa wey dey rekod go rish 232. Difren Iwa get difren karata an like difren kolor an objet. Meni of dis Lwa bi like difren difren saint wey de di katolik riijion as dis saint dem too get difren karata an difren objet. Dey divide di difren Lwa wey de into different group. Dis group nem na nanchon (nations). Inside all dis nanchon, na Petwo an di Rada. Akordin to dis Vodou bilif, Di Iwa dey tok with human-bein by drim an by babalawo (nativ dokto) an dis one dey mek pipo to give Iwa sakri-flie. Di sakri-flie wey dem dey give Iwa dey kontein hanima wey dem don kpai. One of di tins wey Vodou rilijion dey tish bi sey: dorin serimoni, di Iwa fit enta di nativ dokto-dem an wen dis one hapun pipo dey si dis dokto-dem as chwal (wey bi horse) of di Iwa. Wen di Iwa don enta human bodi, di pipo wey dey do Voodou riijion bilif fit tok to human-bein, fit give human advais, or fit mek pesin wey no well beta. Dorin di time wey slave bizness stil dey hapun in di 16th go rish 19th senturi, Afrika pipo wey dey kari go ova-sea kari with dem dia tradishonal rilijion an bilif with dem go dia niu piles. For aria wey French govamet dey kontro like di riploblik of Haiti, di rilijion wey pipo dey do for do for di aria join with Afrika tradishonal rilijion kom enta di di Roman Katolik riijion wey di French govamet pipo dey do. Dis tin hapun in di 19th senturi. Wen Haiti pipo sef dey travul go oda piles like Louisiana ( di piles at dat time de pat of United State), dey helep join hand gada form Louisiana Voodoo. Dis rilijion Louisiana Voodoo no kom dey popular again by di heli 20th senturi. By di time wey 20th senturi wan dey finish, some pipo wey dey worship Voodoo kom dey do wetin dey fit do so dat di rilijion no go kpai patapata.