Jump to content

Luisah Teish

From Wikipedia

Luisah Teish ( dem stil dey kol am Iyanifa Fajembola Fatunmise) na ticha an raita. E dey popula wen e du Jambalaya buk: The Natural Woman's Book of Personal Charms and Practical Rituals. Na shi bi Iyanifa an Oshun chief for Yoruba Lucumi tradition.

Luisah Teish na African-American wey dem bon for New Orleans, Louisiana. Ha papa, Wilson Allen Sr., bi African Methodist Episcopal. Na im papa an mama wok as servant for two generashon, and dem no too far fom slavery. Di mama wey bon am, Serena "Rene" Allen, na Catholic an e get Haitian, French, an Choctaw blood for ha bodi. Ha ancestors stil kom fom Yoruba pipu for West Africa.

For late 1960s, Teish na dansa for Katherine Dunham grup, wia shi len an pafom Afrika an Caribbean dans. Leta, shi komot fom di grup go du choreographer for St. Louis. In 1969, shi join Fahami Temple of Amun-Ra, an na dia shi tek get di nem Luisah Teish, wey mean "adventurous spirit". Afta Georgia Collins komot, shi lead Black Artists Grup (BAG) dans troupe for St. Louis.

For late 1970s, shi enta Lucumi religion an bi priestess. By 1977, shi don dey tich students. Right now, shi dey liv for Oakland, California.

Shi tok sey: "My tradition na joy an celebration—music, dans, song, an fud go holways dey for our service, an we go stil respet chudren. E dey mek pesin hapi an e stil get moment of deep thinking." One raiter tok say for 2010, shi bi "di most popula Yoruba priestess for San Francisco Bay Area." Anoda raiter tok sey shi popular evri wia for wod as raiter an persin wey sabi do rituals for Goddess circles.

Buks wey shi don rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • What Don’t Kill Is Fattening (1980) – Collection of Poems
  • Jambalaya: The Natural Woman's Book of Personal Charms and Practical Rituals (1988)
  • Carnival of the Spirit: Seasonal Celebrations and Rites of Passage (1994)
  • Soul Between the Lines: Freeing Your Creative Spirit Through Writing (1998) – With Dorothy Randall Gray
  • Eye of the Storm (1998)
  • Jump Up: Good Times Throughout the Season with Celebrations from Around the World (2000)
  • What Don’t Kill Is Fattening Revisited: Twenty Years of Poetry, Prose, and Myth (2002)
  • Zulu Shaman: Dreams, Prophecies, and Mysteries (2003) – With Vusamazulu Credo Mutwa and Stephen Larsen.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]