Jump to content

Love Nwantiti

From Wikipedia
Love Nwantiti
single
Part ofCKay the First Chenj-am
TitoLove Nwantiti Chenj-am
Stai of song abi fimAfrobeat Chenj-am
PerformerCKay Chenj-am
Publication date2019 Chenj-am
Record labelWarner Music Africa Chenj-am
Language of work or nameIgbo langwej, English langwej, Arabic, French, German Chenj-am
Awod wey e koletSNEP diamond single Chenj-am
Nominated forBrit Award for International Song Chenj-am
Distribution formatmusic download, music streaming Chenj-am

Love Nwantiti na one song wey Naija singa an song-raita Ckay rilis in 2019. Love Nwantiti bi di sekond song inside extended play habom wey Ckay rilis. Dem do di re-mix of di song (Love Nwantiti Ah Ah Ah) in February 2020. In di re-mix Naija singa Joeboy an Ghana singa Kuami Eugene join sing inside di re-mix. Pipo wey dey live in Naija, midu east, North Africa an meni klub wey de ovasea like di re-mix of Love Nwantiti wel wel. Di French vashon of Love Nwantiti get one French rapa Franglish rap inside.

In 2021, Love Nwantiti klimb up muzik bill board in Europe, Australia, Latin America, an Niu Zealand, an di song rish nomba one in India, di Netherlands, Norway, an Switzerland. Love Nwantiti dey popular akross TikTok. Di song rish nomba 3 on di UK Singu Chart an rish nomba one on di UK indie Singu Chart. Love Nwantiti rish nomba 26 on di US Billboard Hot 100. Di song rish nomba 2 on di Billboard Global 200. Di song stil dey di Canadian Hot 100. On 4 October 2021, di song rish nomba 30 on di Nigeria TurnTable Top 50 Chart an rish nomba 14 on 20 October 2021.