Lola Margaret
Lola Margaret Oladipupo (Dem bon am March 21, 1984) na Naijá aktres, fim podusa an dareto. Lola papa an mama dai in 1999 an na Lola Anti train am fom smol.Pipul no am wel wel afta aktin in di fim Bisola Alanu
How e tek stat life an go skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Lola for Ilesa, Siti wey dey Osun Stet for Sout-West Naijá.Na Osun Stet e tek go pamari an sekondiri skul. Lola rid History and International Relations for Lagos State University.
How e tek stat to akt fim
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na Bolaji Amusa fest introdus Lola Margaret to akting fim.Pipul no am well wel afta e du di fim Bisola Alanu. Lola don akt for plenti fim-dem, som of dem na: Eyin Akuko and Omo Oloro, wey Shi produce . Popula akto-dem like Fathia Balogun an Mercy Aigbe akt for di fim.
Tori Abaut e pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]For June 12, 2017 di Atlanta polis kach Lola for mago mago (fraud). Dis wan happun wen big moni enta e akant an shi wan kolet di moni fom im akant. Dem leta rilis Lola an kárí am bak to Naijá
Fim-dem wey shi don akt
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Bisola Alanu 2014
- Eyin Akuko, 2008
- Omo Oloro, 2016
- Agbara Ife (The Power of Love), 2016