Lere Paimo
Lere Paimo, OFR (bon November 19, 1939) na Naijà fim aktor an e dey mek fim.
How e tek stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na Ogbomosho wey Oyo Stet in Naijá dey tek bon Lere.
How e tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Lere stat to dey akt for 1960 afta e folo Oyin Adejobi Theatre Group, wey pa Oyinade Adejobi bi di oga. Afta dat one, e kon go Duro Ladipo's Theatre Group, na for dat ples e tek akt one play wey bi Obamoro, na im bi Cheif Basa for di play. Pipu sabi am wel wel wen e akt for Ogbori Elemosho, na im akt Soun Ogunola for di fim. E don akt plenti fim an hep plenti pipul do fim sef. For 2015, bikos im sabi akt wel wel for fim, Dem giv am awod wey bi Member of the Federal Republic.Na Olusegun Obasanjo wey bi Presido of Naija bifor giv am di awod. For May 2013, nius kari am say e get stroke, wey e kon leta wel. For April 2014, im win 1 million Naira for one Naija sho wey bi Who wants to be a Millionaire.
Awod
[chenj-am | chenj-am for orijin]Order of the Federal Republic (2005)