Jump to content

Lepa Shandy

From Wikipedia

Folashade Omoniyi, (Dem don am for April 16, 1971) na Naijá wuman wey dey akt yoruba fim.Pipul no am wel wel as Lepa Shandy. pipo no ha wella as Lepa Shandy, as e akt one fim wey get di nem Lepa Shandy.

How e tek stat life an go skul=

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Osogbo for Osun Stet, in Naijá Omoniyi tek kom fom bot na Lagos e tek gro up.Na Legos shi do all im Primari, Sekondiri and Univasiti.Lepa Shandy go Ire Akari Primari Skul, an kom go Isolo kompihesive Hi Skul for im Sekondiri Skool.Shi go Unilag ( University of Lagos) go rid Data Processing. Shi get B.sc for Data Processing.

Hau Shi Tek Wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Omoniyi enta Naijá in 1995.Na fom ledis wey dey do Fashion for stage e tek stat bikos Lepa Shandy no tu get bodi.Shi kom dey do mek-up for aktor bifor shi kom stat to akt fim in Naijá Nollywood indostree in 1996. Dat year, Lepa Shandy akt smol smol pat in Inglish fims.Lepa Shandy fest fim na Breaking Point an afta e du dat fim finish, shi kom enta Yoruba fim indostree.Na di fim wey Bayowa prodorsion do wey di fim nem na Lepa Shandy mek Omoniyi popula. Wen Omoniyi wan du e 45th years old on April 16, 2016, shi tek dat opotuniti tel pipul of im niu fim Eri Ife Leyifor di parti wey shi dey du for im baday.Meni of Omoniyi frend an aktors kom di parti an di bifor bifor fest ledi of Lagos Stet, Abimbola Fashola.

Omoniyi don mari an e bon two pikin

Fim wey e don akt

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • Eri Ife Leyi (2016)
  • Nkan Agbara (2008)
  • Akamo (2007)
  • Iru Kileyi (2007)
  • Iyawo Elenu Razor (2006)
  • Ogo Ìdílé (2004)
  • Iyato (2003)
  • Tim ba T'aiye Wa (2003)
  • Kosorogun (2002)
  • Lepa Shandy (2002)
  • Breaking Point (1996)