Kunle Soname
Kunle Soname na Naija biznesman wey like sports wel wel and na oga of Bet9ja, wey bi one betin website wey e stat for 2013. E bi di first Naija pesin wey buy European futbol klob C.D. Feirense for 2015. E stil stat di private Naija airplane kompani wey dem dey kol ValueJet.
Hau e tek stat life and skul wey e go
[chenj-am | chenj-am for orijin]Soname stodi Estate Management for Obafemi Awolowo University. E finish skul for 1988. E wok as di Executive Chairman of Ikosi-isheri Local Council, and e du dis job until 2011.
Wok and biznes
[chenj-am | chenj-am for orijin]Soname stat Remo Stars Football Club wey di name bifor na FC DENDER, for 2004. Di klob muv from Lagos State go Remo inside Ogun State, and nau dem dey play for di top level of Nigerian Premier League.
Soname bikom di di pesin wey get C.D. Feirense for 2015.
For 2022, Kunle bikom patron for University of Lagos bikos of di gud tins wey e dey du to help pipul. E stil bi pesin wey get Beyond Limits F.A.
Famili life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Soname mari Kemi Soname and dem get one pikin wey bi gel-pikin, ha nem na Erioluwa.
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]