Jump to content

Koffi Idowu Nuel

From Wikipedia

Koffi Ayinde Idowu Nuel, wey pipul sabi as Koffi, na Naija entertainer, komedian, musikshan and aktor. Na pikin wey dem bon for March 11, 1977, to one Togolese mama and one Nigerian papa wey kom fom Ibeju-Lekki.

How e tek stat laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Koffi na for Maroko dem bon am (na old slum for Lagos bifor dem spoil am for 1990, na dia di niu Lekki Oniru dey nau).

E du im primari skul for Lagos, kon go Molusi College for Ijebu Igbo, Ogun State for sekindri skul. Afta dat, e go Universiti of Lagos (Unilag) go stodi Chemistry.

How e tek stat wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1998, Koffi join Theatre 15, wia e len how to akt for stej, dans, and du komedi bifor pley stat (openin akt).

Im fest big chans for TV kom wen e sho for one popula campus komedi sho wey dem kol "Twilight Zone", wey pipul sabi as "Shake Body". Na dia e mek pipul sabi di Dauda character again. As stand-up komedian wey e bi, e dey olways host school events and paform smol komedi bifor drama go stat for students wey pay kom ci dem.

For 2003, Koffi go audition for one big Nigerian komedi sho wey dem dey kol "Night of a Thousand Laughs". Out of 34 komedians, na onli 4 pipul, including am, dem pick to parfom for the yearly sho.

Koffi stil sabi crack joke an parfom for im lokal lagwej Yoruba

YearAwardsCategories
2006Nigerian National Comedy AwardsBest Comedian (Music)
2007Dynamix youth AwardsComedian of the year
2008Nigerian Music Video AwardsBest use of animation
2008Titbits News AwardsMost friendly Comedian
2009-Eminent Achievers Awards (News of The people)Entertainment personality of the year
2010Rubbies Ink Project CapableCapable Youth Ambassador
2011CEPAN AfricaAfrican Comedy Icon
2012Exceptional Magazine AwardsAward of excellence as Most creative Comedian
2013Wed AwardsBest Wedding MC
2013National Association of Nigerian StudentsAward of Excellence
2013Meister FPY AwardsAward of Recognition
2013The Nanny (Best of Nollywood Awards)Best Comic movie
2013The Nanny(Abuja Int'l Film Festival)Most outstanding Comic Movie

Som of im wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

COMfussion (2004)

ABINIBILITY (2006)

TRADofunkHIPsouL (2008)

Workerman movement: all eyes open (2010)

Root&roll: books1&2 (2012)

Gospel truth (2012)

Workerman allstars: famous five (2013)

Ayindeokin: metamorpho (ajala movie sdtrk) (2014 )

Ayindeokin: fresh from the past (2013)

Motor music (2012)

2 Black Birds movie soundtrack (2007)

Mumu movie soundtrack (2009).

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]