Kiru Taye
Kiru Taye na Nigeria raita wey dey sabi how to rait lov stori buk.
Wok wey shi dey do
[chenj-am | chenj-am for orijin]Taye stat to de rait lov buk afta shi no fit faind buk wey tok lof wey hapun for Nigeria or wey dey lik Naija pipu stail.
For 2015, Taye rait one short stori wey shi kol “Lunch with Ifemelu.” Shi tok sey na Chimamanda Ngozi Adichie bùk Americanah na im giv am push am to rait di stóri. Di stóri na abaut Obinze, one man wey don mari, but e dey plan to sleep wit pesin wey pas am wit one old girl Ifemelu wey e lik bifo.
For 2017, OkadaBooks list Taye as di nomba 3 best-sel Nigeria raita.
But, dat sem 2017, shi tok for Brittle Paper blog sey e no easy at hol to get plenti pipul wey go read di tin wey shi dey rait.
For June 2018, pipu yan abaut ha buks to wey fit let pipu sabi an enjoi sex for Afrika. Dem stil tok abaut wetin raita lik Kiru Taye dey do to tel dis kain stori.
One of ha buks, His Treasure, dem use am as ezampu fr dat topik.
Buk-dem wey shi don rait
[chenj-am | chenj-am for orijin].An Engagement Challenge (2012)
.Keeping Secrets (2014)
.Making Scandal (2014)
.Riding Rebel (2015)
.Bound to Fate (2016)
.Bound to Ransom (2016)
.Bound to Passion (2016)
.Bound to Favor (2018)
Award
For 2017, na shi win UFERE Awods as di Author of di Year (di best raitA for dat year).