Jump to content

Kingsley Moghalu

From Wikipedia

Kingsley Chiedu Moghalu wey dem bon for May 7 1963, na Naija man wey sabi ekonomi an politis wel wel. Na im bi President of African School of Governance (ASG) na one big Afrikan school for Kigali, Rwanda wey dey train pipul for how to run govment and publik policy.

Insaid 2009 to 2014, President Umaru Musa Yar’Adua appoint am as Deputy Govnor for Central Bank of Nigeria (CBN). Afta dat one, insaid 2015 and 2017, e tich for Tufts University for America as Profesor of Praktis for International Business an Public Policy.

For 2019 general election, Kingsley contest for president under Young Progressive Party (YPP).

Wok an Biznes

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Moghalu stat Sogato Strategies LLC, one kompini wey dey advais pipul and organizations on how to invest money globally. E stil bi President of Institute for Governance and Economic Transformation (IGET), na one tink tank wey dey do research and giv govment advais on how to run tins for beta ways.

Na im bi di Senior Fellow for Council on Emerging Market Enterprises for Tufts University, and UNDP (United Nations Development Programme) don uze am as Special Envoy — pesin wey dey stan for dem for Post-COVID Development Finance for Africa.

In 2021, na im bi Oxford Martin Visiting Fellow for University of Oxford.

Moghalu stil bi Chairman for Africa Private Sector Summit (APSS) and member of Advisory Council for OMFIF na grup wey join big banks togeda, investment kompinies, and pension funds fom ol ova di wold.


Earli Laif an Edukeshon

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Kingsley Moghalu for Lagos in 1963. im papa, Isaac Moghalu, na foreign sarvis ofisa (pesin wey dey wok for Nigeria embassy for anoda kontri) im mama, Vidah Moghalu, na ticha.

Wen e smol, Kingsley don liv for Switzerland and Washington DC (America) bikos na dia dem post im papa go wok.

For 1967, dem kom bak to Nigeria wen wahala (civil war) wan stat. Dem stay for Nnewi and Umuahia wen dat Biafra war dey hapun. I'll Afta war, Kingsley go Eziama High School for Aba Govment College Umuahia, and Federal Government College Enugu.

E stodi Law for University of Nigeria for 1986, and leta finish Law School for Lagos for am to bi Barrister (lorya wey fit go court).

For 1992, e get Master’s degree fom Fletcher School of Law and Diplomacy, Tufts University, wia e wok as Research Assistant and get Joan Gillespie Fellowship.

Leta, e kolet Doctor of Philosophy (PhD) for London School of Economics for 2005. Im PhD topik na how jostis and politis dey afet international law.

E stil go len mor tins for big schools lik Harvard, Columbia, Wharton, and IMF Institute, wia dem tich am abaut macroeconomics, finance, and leadership.

Moghalu stat wok wit United Nations (UN) for 1992. E do plenti wok for difren countries lik Cambodia New York, Croatia, Tanzania, and Rwanda.

Im first wok as human rights and elections ofisa, leta as politika affairs ofisa, leta as politika affairs ofisa.

For 1997, dem mek am legal advaisa for UN International Criminal Tribunal for Rwanda (UNICTR), wia e hep dem plan polici and tok to media as spokesman. Na dat sem tribunal giv di first intanashonal court jorjment on genocide.

For 2002, e join World Health Organization (WHO) for Geneva, Switzerland as head of global partnerships for The Global Fund to Fight AIDS, Tuberculosis, and Malaria, na big organization wey dey manej $20 billion and dey hep kontris fiaght siknes.

Leta for 2006, Kofi Annan (bifor bifor UN Secretary-General) apoint am join UN Redesign Panel wey luk how to mek UN internal jostis system beta.

By 2017, UNCTAD (anoda UN agency) put am insaid Independent Expert Group on Financing for Development, wia dem diskus how poor kontris fit get moni develop demselves.

For 2008, Moghalu komot from UN and stat e own kompini, Sogato Strategies, wey dey do biznes advis for global kompinies.

Sem 2009, President Umaru Musa Yar’Adua apoint am as Deputy Governor for Central Bank of Nigeria (CBN).

As Deputy Governor, e lerd reform wey hep banks afta di 2008 financial crisis, and e hep bring out di Bank Verification Number (BVN), dat nomba wey everi bank customer must get today.

E manej Nigeria foreign reserve (about $37 billion that time), and wok for payment systems, currency operations, and many financial institutions.

Kingsley don giv big lectures for Oxford University, Afreximbank, and meni oda African and international ples.

In 2024, African School of Governance (ASG) appoint am as dia first President (Vice-Chancellor) for Kigali, Rwanda.

Kingsley marry Maryanne Moghalu, and dem get four pikin.

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]