Kiki Mordi
Nkiru "Kiki" Mordi na Nigeria investigetuv jonalist, filmmeka, raitá a pesin wey get ha own biznes. Shi komot for skul bikas one lekchora for dia dey distob am wit sexual harasmet. Na dis bad tin wey shi ci push am to do di "Sex for Grades" dokumetri wit BBC Africa Eye. Di dokumetri sho how tichas for Nigeria an Ghana dey uze sex tek kolet favo fom students.
For 2016, na shi win awod for Outstanding Radio Program Presenta (South-South) for di Nigerian Broadcasters Merit Awards.
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Kiki Mordi na investigetiv jonalist an radio/televishon pesịn. Shi popula bikos of di 2019 dokumetri wey shi do wit BBC Africa Eye wey dem kol Sex for Grades. Di fim giv voiz to pesin wey sofa sexual harasment for university, both for Nigeria an Ghana.
For 2017, shi stat online petition mek dem stop how Naija polis de use pawa take kolet moni by fors an oppres youth. Shi do dis afta polis enta ha hauz by fors, arest shi an ha boyfrend, say dem be cultists an sey dem de block jostis.
For October 2019, Kiki Mordi an ha BBC Africa Eye team rilis di 13-minit "Sex for Grades" dokumetri.
For 2020, dem list ha nem insaid di Most Influential Young Africans, wit pesin lik Alex Iwobi, Adekunle Gold, Falz, Adetola Nola an odas.
2019 Sex for Grades dokumetri
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 7 October 2019, Kiki an ha BBC Africa Eye team rilis 13-minit dokumetri wey expose how lekchora for University of Lagos and University of Ghana dey sexually haras students.
Pesin wey dem katch for di video na: .Dr. Boniface Igbeneghu – sinior lekchora for Faculty of Arts, Unilag, an pasto for Foursquare Gospel Chorch. .Dr. Ransford Gyampo – Associate Profesor of Political Science for University of Ghana. .Dr. Paul Kwame Butakor – lekchora for College of Education, University of Ghana. Kiki do lik sey shi bi 17 years old pesin wey wan enta university. Shi tok sey di investigeshon tek 9 months. Afta di vidio, Dr. Gyampo sey e go sue BBC. Unilag suspend Dr. Igbeneghu an Foursquare Chorch Kon tel am mek e step down as pasto.
Dem also klos one room wey dem de kol "Cold Room", wey na dia lekturers dey harass girls. Musician Adekunle Gold an im waife Simi praise Kiki for di wok. Even forma Vis President Atiku Abubakar an former Senate President Bukola Saraki beg govment mek dem do somtin quick to stop sexual harasment for university.
Kiki tel Sahara Reporters sey shk don dey receive smol-smol threat sins shi finish di wok.
On 8 October 2019, BBC rilis full one hour dokumetri wey sho more lekchoras wey dey do di sem bad tins. Bikos of dis, dem suspend Dr. Samuel Oladipo fom Ekonomics Department for Unilag.
On 9 October 2019, Naija Senate ansa pesin wey dey vex abaut di mata an bring bak di anti-sexual harasment bill.
On 9 July 2020, Senate pas di bill an sey if enibodi do am, he fit go prison for up to 14 years.
Awods and Norminashon
[chenj-am | chenj-am for orijin]| Year | Award | Category | Result | Recipient |
|---|---|---|---|---|
| 2020 | International Emmy Awards Current Affairs & News | Current Affairs | Nominated | BBC Africa Eye: Sex for Grades |
| 2019 | People Journalism Prize For Africa | Prize for Journalism | Won | Herself |
| The Future Awards Africa | Prize for Journalism | Nominated | Herself | |
| 2016 | Scream All-Youth Awards | On-air Personality of the Year (Female) | Nominated | Herself |
| Nigerian Broadcasters Merit Awards | Outstanding Radio Program Presenter (South-South) | Won | Herself | |
| 2015 | Nigerian Broadcasters Merit Awards | The Most Promising Young Presenter (TV/Radio) | Nominated | Herself |