Jump to content

Kidi

From Wikipedia

Dennis Nana Dwamena (dem bon am for 18 August 1993), wey pipul sabi as KiDi (di nem mean “rhythm”) na Ghanaian singa and songraita. Pipul sabi am wel for di kain musik wey e dey do Afrobeats and High-life.

Early laif and how e popula

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen KiDi dey stodi Economics and Information Studies for University of Ghana, e love for music no let am rest. E mek am stat to paform for one program dem dey call Moonlight Café, na one sho wey dey hep up-and-coming musikshans sho wetin dem fit do for Ghana university campuses. E stil du plenti kova of oda pipul songs.

For 2015, KiDi shuz say mey e trai e luck for MTN Hitmaker kompetition. E no jos trai, e win di kompetition! Afta dat one, Lynx Entertainment sign am. KiDi stat to popula wel wel for 2017 wen e drop song wey e kol “Say You Love Me.” Na im rait di song, arenj am and stil produs am by imsef. Dat sem year, e drop anoda jam Odo” for July 2017. Leta, e remix am wit Nigerian stars Davido and Mayorkun for December 2017, and anoda banger “Adiepena” for April 2018. Na so pipul stat kol am one of di fastest-rising stars for Ghana. ‎

Hau e dey pafom and wok for music

[chenj-am | chenj-am for orijin]

KiDi don paform for plenti big shos lik:

‎.Rapperholic Concert 2017

.Ghana Music Honors 2017

‎.December to Remember 2017

.S Concert 2017

.Ghana Independence Celebration (61st edition) for London (Indigo 02) for March 2018.

‎.E don share stej wit big Afrikan musikshans lik Sarkodie, Samini, Shatta Wale, MzVee, WizKid, Tiwa Savage, Efya, and Patoranking.

‎.No be only sing KiDi sabi, e don produs song for oda musikshans tu, and wok togeda wit Ghana top produsas Richie Mensah. E don rait song for artists lik MzVee and Adina, and don collabo wit pipul lik Tic Tac, Ko-Jo Cue, Magnom, and Kwesi Arthur.

.For 2018 Vodafone Ghana Music Awards, KiDi get 6 nominashons, including:

‎*Best New Artiste

  • Afro-pop Song of di Year

‎*Male Vocalist of di Year

E leta win High-life Song of di Year for April 2018.

‎*Leta, e kom kolt Artiste of the Year for both 3Music Awards and TGMA 2022.

KiDi don rilis 2 studio albums and 2 EPs.

Im fest album “Sugar” drop for May 31, and e evun rilis one muvie wit di sem nem Sugar for Accra, Kumasi, and UK dat sem year.

‎.For 2020, e drop Blue EP, wey be lik warm-up bifor im sekond album “The Golden Boy.” Songs for di EP wey get:

.“End in Tears”

‎.“Say Cheese” ‎ ‎.“One Man” (wey feature Adina)

‎In 2021, KiDi kom rilis im sekond album “The Golden Boy.” The album win Album of the Year for 2021 Vodafone Ghana Music Awards. Insaid di album, you go faind hit songs lik “Mon Bebe,” “Cyclone,” and “Touch It” — the song break record the most streamed Ghanaian song for Spotify.

KiDi go St. Anthony’s School for Accra for primari skul edukeshon, wia e du wel for buk. Afta dat, e go Accra Academy for sekondri skul edukeshon. Wia e finish high school, dem admit am go University of Ghana, Legon, mek e stodi Economics and Information Studies. In 2016, e graduate fom dia.

‎KiDi get one pikin, na boi im nem na Zane

‎==Wia Dem gada tori==