Jump to content

Kate Rusby

From Wikipedia

Kate Anne Rusby (dem bon am 4 December 1973) shi dey sing lokal song an dey rait song fom Penistone, West Riding of Yorkshire, England. Dem dey kol am "Barnsley Nightingale", shi don dey difren British lokal festival, an dem sabi am as one of di singa wey dem sabi pas for English lokal singas. In 2001 The Guardian tok abaut am sey na shi bi di British star wey pipul go ear im sweet voice. In 2007 for BBC website dem kol am first niu lady for lokal music. Shi dey insaid di singa wey dia nem dey insaid pipul wey fit win Mercury Prize.

Hau e tek wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Rusby insaid famili wey hol of dem sabi sing, in 1973 for Penistone, West Riding Yorkshire, England. Afta shi don len hau to sabi pley guitar, fiddle an piano, an stil sabi to dey sing, shi don pley for meni festival wen shi dey smol an wen shi dey gro, bifor shi Kon go join ( an na shi Kon leta bi di lead Vocalist of) di Female Celtic folk band the poozies. Na for 1995 shi rilis album wey mek plenti pipul sabi am, Kate Rusby & Kathryn Roberts album wey shi du wit im frend wey dey sing abaut lokal tins song Kathryn Roberts . In 1997 Roberts rekod im fest solo album, Hourglass. Na im famili hep am wit di fest solo rekod. Afta wey plenti pipul don sabi am for d wod im famili no stop to dey hep am insaid all im wok.

Rusby dey insaid one grup , Equation, wey leta chenj to Cara Dillion wey dia wok na to sing abaut lokal tins. Wen di grup stat dem get difren singa insaid lik Kathryn Roberts an pesin wey im nem dey for insaid singa wey fit win Mercury Awod Seth Lakeman, an im broda, Sean Lakeman. Im fest EP, wey dem du mek dem get kontrat wit WEA.

Song wey Rubsy no rilis "Wandering Soul" na song wey shi du for ''Billy Connolly's World Tour of New Zealand", wey bi pat of BBC television sho in November 2014.

E du song wit Roman Keating wey mek am go up for UK Singles Chart, dia song "All Over Again" rich nomba 6 in June 2006. Shi stil du song solo album of Roody Woomble , wey dey insaid pipul wey sing Idlewind. Dat same year im Cover of The Kniks' "The Village Green Preservation Society" dem uze for BBC one television komedy ''Jam and Jerusalem''. Rusby rait difren new songs for di komedy fim, an na shi pipul tok sey sing for di sho music.

Na for 2007 Cambridge Folk Festival dem let pipul no sey di album ''Akward Annie'' dey kom out, dem Kon rilis am on 3 September 2007. 'The Village Green Preservation Society dey insaid di album as jara trak. For 2018 shi rilis ''Sweet Bells'', na album wey plenti lokal krismas songs wey Rubsy du. Shi kon du anoda 3 krismas albums: ''While Mortals Sleep'' (2011), ''The Frost is All Over'' (2015), Angels and Men (2017), and Holly Head (2019). Na evri December, Rubsy dey travu go du December sho for United Kingdom in 2010, Rubsy rilis anoda song ''Make the light'', na song wey shi don rait down tay tay. Insaid 2014 shi rilis album wey bi Ghost, lokal song dey insaid an three oda Rubsy songs. Rubsy fourteen solo album na ''Life in a paper boat'' wey shi rilis in 2016, year wey folo shi rilis fourth krismas album "Angels and Men". In May 2019, Rubsy rilis anoda album wey bi "philosophers, poets & Kings", im 5th krismas album folo dat one afta 6 months.

Wen e don dey enta 10 years, Rubsy rilis kova album of popula songs lik Shake it off (Taylor Swift), Everglow (Coldplay) an Friday im in Love (The cure) an som plenti oda songs. Na wen Covid- 19 pandemic dey shi produs di album, Kate tok sey e dey im plan to rilis di album dis year, an sey Lockdown kon mek am pasonal. Wok wey shi jos du niu na '30: Happy Returns' an shi du parti bikos shi don rich 30 years wey e don dey sing. Di Songs na di niu ones wey Kate like for im wok. Dem rilis am May 2022.

Im pasonal life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

In August 2001, Rubsy mari Scottish man wey dey sing lokal song an e dey insaid im band memba, John MacCusker ( e dey insaid Battlefield band]] , na im produs meni of Rubsy rekodin rich ''The girl who couldn't fly'', but dem no dey togeda again in 2006. In June 2010, shi mari Irish singa Damien O'kane, shi bon two pikin for am.

Som of im wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.Hourglass (1997)

.Sleepless (1999)

.Little Lights (2001)

.10 (2002)

.Heartlands (2003)

.Underneath the Stars (2003)

.The Girl Who Couldn't Fly (2005)

.Awkward Annie(2007) No. 2 UK Indie

.Make the Light(2010)

.20 (2012)

.Ghost (2014)

.Life in a Paper Boat(2016)

.Philosophers, Poets & Kings (2019)

.Hand Me Down(2020)

.30 (2022)


Christmas albums

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.Sweet Bells (2008)

.While Motals Sleep (2011)

.The Frost is All Over (2015)

.Angels and Men (2017)

.Holly Head (2019)

Mercury Music Prize

.1999 Sleepless - norminated

BBC Radio2 Folk Awards

.2000 Folk Singer of the year - Winner

.2000 Best album Sleepless - Winner

.2002 Best Original Song who will sing lullabies - winner

.2006 Best Original Songs: "No Names" (wit Roddy Wombie from Idlewild) - norminated

.2006 Best Live Art - winner

.2014: BASCA Gold Badge award