Karimot Odebode
Karimot Olábísí Odébòdé na Nigerian wey dey tok abaut beta edukeshon, sheibe lorya, poet, an shi bi di pesin wey stat Black Girl's Dream Initiative. Na grup wey yung pipu dey run, an di aim na to mek sure sey boys an girls get di sem opportunity.
For 2022, shi be di onli Nigerian wey dem put for di list of 17 yung pipu wey United Nations chuz as Yung Leaders for Sustainable Development Goals (SDGs). Dem anous dis thing during di 77th UN General Assembly meeting.
Shi wok as Youth Champion for ONE Campaign for Nigeria. For dia, shi dey hep push di faight against wahala of pipu no get moni or gud life. Dat sem 2022, di Ministry of Youth an Sports for Oyo State put her nem insaid 100 yung pipu wey dey do beta tins for society.
Shi rait one buk wey get 156 pej an insaide am, shi put ova 100 poems. Di buk na Noirledge Poblishin poblish am for 2022, an e tok abaut how wumen fit tok dia mind an express diasef.