Justina Eze

Justina Eze nah Nigerian diplomat and politician wey be former member of House of Representative for Uzo Uwani for Nigeria's Second Republic.[1]
How her life take start
[chenj-am | chenj-am for orijin]Eze been come from Udenu Local Government Area for Enugu State dem born her for Nimbo/Uzuwani Local Government Area of Nsukka senatorial zone for Enugu State, and she bin also serve as former Nigerian ambassador for Guinea Bissau and Cape Verde and as former Presidential Liaison Officer[2] for House of Representatives for 2002 for Olusgeun Obasanjo's democratic rule. [3]
Work wey she do for politiks
[chenj-am | chenj-am for orijin]She bin be de first woman[4] from de Eastern Region, Nigeria wey enter House of Representatives for 1979. She follow Dr. Nnamdi Azikiwe and Chief Jim Nwobodo build National peoples party (NPP) and she bin be one of de three women wey enter de Federal House of Representatives for 1979. She still be one of de founding mothers of People Democratic Party(Nigeria). She dey always encourage women and open road for dem, make dem dey enter politics so Throughout her political career, Eze bin dey support and find way make more women enter politics for greater participation of women in politics con join government and leadership positions .[5]
Biznes work
[chenj-am | chenj-am for orijin]Before she enter politics, Justina Eze nah trader, wey don build business wey dey do well ,through de selling of salt and other goods. Later she con start to dey invest for coral beads, gold, and diamonds.[3][5]
Court matter
[chenj-am | chenj-am for orijin]For de year 2023, Eze bin carry First Bank of Nigeria go Court because of one of her safe deposit wey bin dey miss. De box bin contain gold, diamonds, coral beads, and other important things wey worth about ₦1 billion. According to wetin court papers Nigerian newspapers report, she been deposit dis items for de bank's Enugu branch before she go her diplomatic posting for Cape Verde.[6][7]
References
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ Shaibu, Inalegwu. "FUEL SUBSIDY: We can't afford to blow up Nigeria – Eze, first S/East female lawmaker". Vanguard. Lagos, Nigeria.
- ↑ Uganwa, Austin (2014-11-22). Nigeria Fourth Republic National Assembly (in Ínglish). Xlibris Corporation. ISBN 978-1-4990-8876-2.
- 1 2 "Nigeria: Women in Politics: Women need to work harder for the 2007 elections -- Ambassador (Mrs) Justina Eze". Vanguard, Lagos. AllAfrica. 15 November 2004. Retrieved 22 May 2026.
- ↑ Africa Woman (in Ínglish). Africa Journal Limited. 1980.
- 1 2 "Justina Eze was a leading force in shaping Nigeria's democratic journey". archivi.ng (in Ínglish). Retrieved 2026-05-22.
- ↑ "Justina Eze Archives". The Guardian Nigeria News - Nigeria and World News (in Brítísh Ínglish). Retrieved 2026-05-22.
- ↑ Olabimtan, Bolanle (2023-05-12). "Ex-Nigerian diplomat sues First Bank over 'missing safe deposit box containing jewellery'". TheCable (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2026-05-22.