Jumoke Verrrissimo
Jumoke Verissimo (dem bon am on 26 December 1979 for Lagos) na Nigerian poet, pesin wey dey rait novel, chudren buk raita an person wey dey review or tok abaut oda pipu wok.
Life=
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Jumoke for Lagos. Shi get masta digre for African studies fom University of Ibadan, an bachelor digre for English literature fom Lagos State University. Shi don wok as editor, sub-editor, copywriter, and journalist wey dey wok on her own for big niuspepa lik The Guardian an NEXT. Now shi dey liv for Canada wit ha pikin an she dey wok as assistant professor for Toronto Metropolitan University.
Ha raitin wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Peoples Daily tok sey ha poetry collection strong wel-wel, say e tok abaut pain an difren kain emotion wey dey kom out fom pipu bodi even wen dem no rili sho am, an e kari voice of protest wey kom fom evribodi togeda. Di Punch stil talk sey Jumoke na one of di pipu wey go chenj literature for Naija afta shi poblish ha first buk wey meni pipu lik wel-wel.
Dem don poblish ha wok for meni plez lik: .Migrations (Afro-Italian) .Edited buk by Wole Soyinka .Voldposten 2010 (Norway) .Livre d'or de Struga (Poets of di world onda UNESCO) an meni oda pepa an online magazine dem. Som of ha poems don dey translated to oda lagwej lik Italian, Norwegian, French, Japanese, Chinese, an Macedonian. Ha novel for 2019, A Small Silence (Cassava Republic) win Aidoo-Snyder Prize for best original creative wok. Pipu wey give di awod, tok sey di buk dey pawafu bikos: E tok wel abaut how pesin fit dey sofa fom stress afta bad experience. .Di stori sound real .E relate to real-life wahala .E sho norma life in way wey sweet to read .E uze swit poetic style .E stil get smol humour insaide. Ha chudren buk Grandma an di Moon's Hidden Secret enta longlist for di 2024 Nigeria Prize for Literature.
Awod an Norminashon
[chenj-am | chenj-am for orijin].2009: Carlos Idzia Ahmad Prize – First Prize for first poetry buk. .2009: Anthony Agbo Prize for Poetry – Second Prize for first poetry buk 2012: Chinua Achebe Centre Fellowship 2020: Shortlist for Ondaatje Prize – A Small Silence 2020: Win Aidoo-Snyder Book Prize for best original creative work.
Novel
A Small Silence, Cassava Republic, London, 2019. ISBN: 9781911115793.
Poetry Buk
I Am Memory, DADA Books, Lagos, 2008. ISBN: 978-978-088-065-1 The Birth of Illusion, FULLPOINT, Nigeria, 2015. ISBN: 978-978-946-697-9
Buk wey shi hep edit
Co-editor: Sọ̀rọ̀sóke: An #EndSARS Anthology, Noirledge, Nigeria, 2022. ISBN: 9789785874693.
Chudren Buk
[chenj-am | chenj-am for orijin]Grandma and the Moon's Hidden Secret, Cassava Republic, London, 2019. ISBN: 9781913175351 Àdùkẹ́, Ìyá Àgbà Àti Àṣírí Òṣùpá (Yoruba version), Cassava Republic, London, 2019. ISBN: 9781913175382