Jump to content

Juliet Akano

From Wikipedia

Juliet Nene Akano (born May 22, 1963) nah Naija politikishian. Dem elect to de House of Representatives for 2007 and 2011.[1]

How she start her life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born Akano for Kano State for 1963 to Godson and Alice Obasi from Arochukwu. She bin no grow up for Kano state as her family move when she still be small baby. As small pikin she live for Enugu where her mama dey teach and her father dey work for Ministry of Finance's offices.[1]

Work wey she do for politiks

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bin elect am go National House of Assembly to represent Nwangele/Isu and Njaba local government areas for Imo State.[1] She serve there from 2007[2]and for dat time she be de Deputy Chairman of the Committee for Women Affairs.[1][2]

For her time for di 6th National Assembly, she serve as Deputy Chairman of House Committee for Women Affairs.

Akano time for lawmaking start from 2007 go reach 2011, during dat period she dey take part for parliamentary work and she dey represent her constituency.[2]

Projects she do for her time as lawmaker

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 2008, Akano announce education scholarship programme wey go help support young students in her constituency. De project give scholarships to 20 pupils wey start from Primary Three so dat dey go fit complete their primary school. Students wey comot as de best performers for Primary Six for their local government areas still collect another scholarships go junior secondary school. Dem do de programme to encourage better education development and make school easier for children for her constituency.[3]She bin dey House of Assembly reach 2011.[4]

Wetin women dey do for Nigerian politics

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akano bin dey among small number of women wey dem elect enter Nigeria House of Representatives for 2007 general elections. For dat time, women bin no dey plenty for National Assembly, and di lower chamber get plenty men pass women.

She bin dey among de eleven women wey dem elect for 2007, wey still win re-election for 2011, when di lower house nearly be 95% men. Other women wey dem elect include Mulikat Adeola-Akande, Abike Dabiri, Nkiru Onyeagocha, Uche Ekwunife, Nnena Elendu-Ukeje, Olajumoke Okoya-Thomas, Beni Lar, Khadija Bukar Abba-Ibrahim, Elizabeth Ogbaga and Peace Uzoamaka Nnaji.[4]Their presence for parliament show say dey still dey try increase how women dey take part for Nigerian politics.

Plan to become senator

[chenj-am | chenj-am for orijin]

After her time for House of Representatives, Akano later try go for higher political office. For 2015, she declare say she wan contest for seat for Nigeria Senate to represent Orlu senatorial district for Imo State. For 2015, she be candidate wey wan become senator for upper chamber for Orlu, for Imo State.[5]

Her candidacy receive plenty support from plenty youth groups and political supporters wey dey for Orlu zone.[6]

  1. 1 2 3 4 Olaode, Funke (2007). "Nigeria: Women Are Better Managers in Politics - Honourable Juliet Akano". Retrieved 3 May 2020.
  2. 1 2 3 "Citizen Science Nigeria". citizensciencenigeria.org (in Ínglish). Retrieved 2026-05-13.
  3. ↑ Uneze, Amby (2008). "Nigeria: Lawmaker Sets Up Scholarship Scheme". Retrieved 17 January 2021.
  4. 1 2 "Women who will shape Seventh National Assembly". Vanguard (in Amẹ́ríka Ínglish). Lagos, Nigeria. 2011-06-06. Retrieved 2020-05-03.
  5. ↑ Politics, iKNOW (2014-07-05). "Nigeria: Female Politician Declares Interest in Orlu Senatorial Seat". International Knowledge Network of Women in Politics (in Ínglish). Retrieved 2020-05-03.
  6. ↑ "Orlu Student Leaders Back Hon Juliet Akano For 2015 Senate" (in Amẹ́ríka Ínglish). Retrieved 2026-05-13.