Jump to content

Julie Okoh

From Wikipedia

Julie Okoh (wey pipu dey sabi as Julie) Omonukpon Omoifo Okoh (dem bon am for Ubiaja on 5 August 1947) na Niaija wuman wey sabi rait play, tich for skul, an dey faight for wumen right. Shi be profesor for theatre theory for University of Port Harcourt fom 2004 rish 2017. Ha plays dey tok abaut wetin wumen dey fez for society. Som of ha popula plays na The Mannequins (1997), Edewede (2000), an Closed Doors (2007). Shi don get big awod lik Fulbright Scholar an for 2011, Society of Nigerian Theatre Artists (SONTA) gi her Lifetime Achievement Award.

Julie Okoh na Edo woman wey dem bon for Ubiaja, Edo State (southern pat of Nigeria). Ha papa nem na Augustine Azamuoisa Omoifo. Na ticha an court clerk. Ha mama na wuman wey sabi sew cloth an manej shop. Julie na nomba five for insaide eight pikin wey dem bon. Ha papa lik music wel-wel an dey play guitar, ha mama dey tel tradishonal stori an dey dans Ikhio dans-drama.

Julie mari Joseph Donatus Okoh (wey dem born for 1941). Na profesor for edukeshon for di sem University of Port Harcourt. Dem get four pikin togeda.

Afta shi finish primary school for Ubiaja, Julie go secondary school for Our Lady of Lourdes for Uromi. Afta dat, shi find wok for Ministry of External Affairs for Lagos. Wen shi dey wok, shi stil rait GCE exam – both ordinary an advanced levels. Bikos shi do wel for di exam, dem admit ha go Federal Training Centre to train as secretary wey mean say she sabi speak and write two languages. For 1972, shi get admission go Loyola University for Chicago, wia shi stodi French an English Literature an finish for 1976.

Shi stil go do master’s digre for French Literature for University of Alberta (1979). Leta, shi go University of Bordeaux III wia shi stodi theatre for both French an English. Shi get anoda master’s digre for 1989 an PhD for 1991.

Insaid 2000 an 2001, shi travu go US again, dis taime as Fulbright Scholar for Smith College. Shi tich as guest lecturer for North Carolina Stet University an University of Massachusetts at Amherst. For 2004, shi stat wok as profesor for University of Port Harcourt, an shi tich dia until shi retire for 2017.

For 2012, shi giv big lecture wey shi kol “Towards Feminist Theatre in Nigeria.” For dat tok, she xplain sey:

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]