Jump to content

Joy Chinwe Eyisi

From Wikipedia

Joy Chinwe Eyisi (dem bon am on 3 September 1969) na Naija profesor, buk raita, skola, tisha, an pesin wey dey helep pipo fom Igbo tribe. Fom 2006 go rish 2011, Eyisi bi di Head of Dipatmet for English Langwej an Literature for Falkoti of Arts insaide Nnamdi Azikiwe Yunivasiti (NAU) wey de Awka, Anambra Stet. Nau, shi dey sarf as Depoti Vaiz shanselor (Akedemi) for National Open University of Nigeria (NOUN), an shi stat dis wok on 26th October 2017. Bifor dat, Eyisi bi di pesin wey de in chenj of NOUN Study Sentra insaide National Assembly for Abuja. Shi win di eleshon wey Yunivasiti sinet do on 25th October 2017, an shi tek ova fom Professor Patrick Eya. Shi be di fest wuman wey get dat kain big akedemi posishon for di skul.

Earli life an marej

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eyisi ko fom Eziora Vilej for Adazi-Ani, Anaocha Lokal Govment Aria, Anambra State, for southeast Nigeria. Afta shi do ha NCE (National Certificate in Education), shi mari Chief Ray Ifeanyichukwu Eyisi – one knight for Anglican Church na biznesman fom di sem vilej. Na for dat dia vilej shi first meet am. One of dia pikin, Noble Eyisi, don be President of Student Union Government (SUG) for Nnamdi Azikiwe University. Dia onlu daughter, Joy Eyisi Junior, wey rait one novel dem kol Willy-Nilly, na first class graduate of English fom Covenant University, Ota, Ogun State.

Edukeshon an wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eyisi tok sey shi no too sabi buk wen shi smol – shi dey get bad result for skul. Shi stat primari school for Central School, Nnewi, but shi finish ha primary education for St Jude’s Central School, Adazi-Ani in 1981. Dat sem year, shi rait Common Entrance Exam, get beta result, an enta Girls’ High School, Agulu, wey Rev Sister Miriam Theresa Ozomma dey head dat time. Shi finish secondary school in 1986.

Fom 1986 to 1989, shu go Anambra State College of Education, Awka to get ha NCE. Leta, shi go University of Nigeria, Nsukka (UNN) go stodi Education an English, an shi graduate wit Second Class Upper. Afta ha NYSC for 1994, shi enta Nnamdi Azikiwe University again go do Master’s digre for Education Administration an School Supervision. Even wit ASUU strike dat time, shi stil graduate as best student. Fom 1997 to 2000, shi go bak UNN go do MA/PhD.

Shi stat to tich part-time for Nwafor Orizu College of Education, Nsugbe, an also part-time for UNIZIK fom 1996. By year 2000, UNIZIK giv ha full-time lecturer wok. Fom Lecturer I to full Professor tek ha onli 7 years, an by 1st October 2007, shi bi di yungest profesor for di skul. Ha influence hep build Department of English an Literature near Faculty of Law for UNIZIK, wit hep fom one transporter, Chief Godwin Ubaka Okeke (MON). Shi don stil tich as Visiting Professor for schools like St Paul University, Awka (2002–2005) an Ebonyi State University, Abakaliki (2001–2005).

Notable Publications

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eyisi don rait plenti buks, artikus, an materials wey piou dey uze for school. Som of ha buks na:

.Oral English for Successful Performance and Phonetics of English: dem do am to hep pipu len hau to kil English wods wel wel.

.Common Errors in the Use of English: shi point out common mistakes pipu dey mek for English.

.A Grammar of English: The Student’s Companion: na guide for pipu wey dey len English as sekond lagwej.

.The Mechanics of Reading Comprehension and Summary Writing: sho how to sabi English wey dem rait wel wel.

The Secret of Academic Success: na buk wey dey tel students to wok hard.

.English for All Purposes, wey shi rait wit Chinonso Okolo an Joseph Onwe, na quick guide to hep pipu rememba important tins abaut English.


Advocacy an use of english

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Som of di quotes wey shi lik to use na:

.“Aspire to the zenith. Never look for Very Good where Excellent is possible.”

.“The noblest search is the search for excellence.”


Eyisi bliv sey mek we use English wey evribodi fit understand for global edukeshon. Shi don win lokal an internashonal awods for ha wok for edukeshon. Shi dey holways sopot beta tichin an uze of English espeshialy for pipu wey dey len am as second lagwej.

Shi tok sey skul need lagwej lab, beta library, an oda tins to hep students an tichas do wel. For one seminar, shi even promise gift to tichers wey fit spell 50 wods well, but meni no fit even spell 10 koret.

For one wokshop titled The Role of Women in Empowering Change, shi tok sey wumen sopos go skul an get beta edukeshon even if dem don bon pikin. Shi sey: “Girl pikin supos go skul, mek shi len wel wel.”


Awods an Memberships

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Eyisi don win plenti awods lik:

.2004 Silver Jubilee Merit Award from Bishop Crowther Seminary, Awka

.2005 Recognition Award from St. Jude’s Anglican Church, Adazi-ani

.2005 Great Woman of Honour Award from BBC Club, UNIZIK

.2006 Rotary Club Integrity Award

.2007 Scholarship Award from English Language Teachers Association of Nigeria

.2008 First Bank of Nigeria Leadership Award

An meni odas fom students, schools, an organizations.


Shi bi memba of meni profeshonal grups lik:

.National Association of Teachers of English

.Association of Nigerian Authors (ANA)

.English Language Teachers Association of Nigeria

.An oda ones wey sopot lenin an knowledge