Jump to content

Jordan Ifueko

From Wikipedia

Jordan Ifueko (dem bon am on August 16, 1993) na Nigerian-American raita wey dey rait abaut buks wey dey tok abaut magical wold an storis for yung pipu. Shi popula wel-wel bikos of ha buk Raybearer, wey enta New York Times Bestseller list. Shi leta rait di second pat of di stori, Redemptor. For August 2024, shi poblish anoda buk wey stil hapun for di Raybearer wold, di title na The Maid and the Crocodile. Shi stil dey rait shot shot storis, an dem don publish som insaide one magazine wey dem kol Strange Horizons.

How shi tek gro up

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Jordan Ifueko na Southern California dem bon am, an ha papa an mama na Nigerians wey muv go America. Ha mama na Yoruba, an her papa na Benin. Jordan tok sey as shi dey grow, ha mama dey holways tel ha stories fom West Africa — na so shi tek stat to lik storiteling. Shi no go normal school; ha papa an mama na dem tich ha for hauz. Leta shi go George Fox University wey dey Oregon. Now shi don mari an shi dey liv for Atlanta wit ha famili.

How shi tek stat ha wok as raita

[chenj-am | chenj-am for orijin]

As shi stil be teenager for 2008, Jordan stat to write fanfiction — stori wey base on Jane Austen buks — for Neopets. Di stori even enta Neopets niuzpepa wey dem dey kol The Neopian Times.

Ha first buk Raybearer kom out for August 18, 2020. Shi tok sey di stori na mix of African kolsho an oda kolshos fom di wold. The book blow! E enta New York Times Bestseller list. Di buk etil enta shortlist for difrent awods lik:

.Andre Norton Award

.Ignyte Award (Best Young Adult Novel)

.Goodreads Choice Award (Best Debut Novel and Best Young Adult Fantasy & Science Fiction)


.Di bik even enta American Library Association (ALA) list of best audiobooks an best yung adult fiction. .Di second buk, Redemptor, kom out for 2021, and e stil kolet nominashon for meni awods again.

For September 2021, Netflix anous sey dem wan turn Raybearer to TV series. Dem dey wok on am wit Gina Atwater, Sugar23, an Macro Television Studios.

For 2024, Jordan tok sey shi go rilis niu buk The Maid an di Crocodile. Na fantasy again, an di stori stil hapun for di Raybearer wold. The book kom out August 13, 2024.

For July 2022, Marvel Comics tok sey Jordan go rait niu comic for Moon Girl & Devil Dinosaur, an Alba Glez na di artist wey draw di pishis. Di comic kom out December dat sem year.


Buks wey shi don rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Novels:

.Raybearer – Amulet Books (2020)

.Redemptor – Amulet Books (2021)

.The Maid and the Crocodile – Amulet Books (2024)

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]