John Ogu

From Wikipedia

Ugochukwu John Ogu(bon 20 April 1988) na Naija profeshonal futbol pleya wey dey pley as midfida for Isreal klob Hapoel Nof Hagalil an di Naija nashonal tim.

Early Karier[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ogu stat to dey pley futbol for Akwa Starlet, Akwa United, an di flying Sport Akademi for youth department. On 23, Septamba 2006, e stat im sinior karier for Slovenia wen e sign for Drava Ptuj from do Slovenia PrvaLiga. Ogu skore eight goals in 97 appearances for four years wey e yuz for their.

In Portugal[chenj-am | chenj-am for orijin]

In di soma of 2010, Ogu go pley for Atlético Clube de Portugal, afta im kon stil pley for Terceira Divisão in Portugal. Afta six months e go Spain as e sign for Almeria bot pley in Almeria B for third divishon. For Novemba 2011 go bak to Portugal an join Leira, bot wen di sisin finish for day year do tim drop go sekond divishon.

For July 2012, Ogu muv go Academica from Premiere Liga. Ogu skore im fest goal for third round of di Portuguese Kop egenst Ponte da Barca. E skore im fest ligue goal egenst Victória de Setubal in an impotant goal wey hep im klub to stey for top divishon. Ogu pley for two years for Academica an skore one goal in 27 ligue appearances.