Jesse King
Jesse "BUGA" King na Naija musikshan wey dey sing for Yoruba lagwej pas. Im song dey kari Yoruba kolsho and dia proverb join bodi. For 2016, e kom sopot President Muhammadu Buhari, say mek pipul giv am chans so e go fit hep stabilize Nigeria ekonomi.
Musik wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]E drop im first album for 2006, di nem na BUGA. Bifor dat taim, e dey do short musik or advert wey dem dey pley for redio, and e stil wok as produsa. E don wok bifor for Ekiti and Ondo State Broadcasting Corporation.
Na Auchi Jesse King kom fom, na for Lagos e gro an liv. Na Yoruba pipul, espeshialy pipul wey dey Ondo State, dey enjoi e musik pas.
E go skul for Ondo State University, e leta go skul for Ondo State University, wey leta mov go Akungba-Akoko, wey dem dey kol Adekunle Ajasin University.
Wia dem gada tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- Jesse King urges Nigerians to support Buhari.Green News Nigeria. 2016-05-31. Retrieved 2024-09-04.