Jump to content

Jengu

From Wikipedia

Jengu ( if dem pass one dem dey kol dem Miengu) na wota spirit wey de di tradishonal tori of Sawabantu grup of Kameroon. Di pipo of Duala, Bakweri, Malimba, Subu, Bakoko, an Oroko pipo stil bilif in Jengu. For Bakweri pipo, dem dey kol am liengu. (if dem pass one na maengu). As Bakongo bilif in Simbi an Mami Wota na so di Sawabantu grup of Kameroon bilif in Jengu. Di Bakoko pipo dey yuz Bisima if dem wan tok of Jengu. Pipo dey diskrib jengu as mami wota spirit. Jengu spirit dey live inside rivas an sea. Dem dey give gud-luck to pipo wey de woship. Jengu spirit fit mek pesin wey sik wel an dey fit diliva mesej of pipo wey dey alive to spirit of oda wold Bikos of wetin Jengu spirit dey do, dem get plenti folowas among di Duala pipo. For Bakweri pipo, eni tineja wey wan bikom mashon wuman go do sakrifies to Jengu spirit fest

Di wota spirit

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  • wetin dem luk like==

Na difren kolsho get difren tori for how Jengu spirit luk like. One koko wey konet all dia tori bi sey Jengu spirit na Mami Wota spirit. Jengu spirit fine wel wel an dem get long hair an dem get teeth wey fine bikos of smol gap wey in dia teeth. rivas, sea, ocean, an lake. Jos like di bilif wey Kongo tradishonal rilijion bilif about simbi, Pipo bilif too sey Jengu sef bi di spirit wey dey kontro wetin dey hapun for di wold. Dem stil bilif sey na Jengu spirit dey kontro wetin go hapun to human-bein wey de on top wota or wota hanima-dem wey de inside wota.

Bikos pipo bilif sey Jengu fit ditamin destini, pipo bilif sey dey fit mek pesin get beta tins of life. Dis one dey mek some pipo to dey woship dem. Di Sawabantu pipo dey sakrifies to Jengu an dem dey do big big festiva for am. Na di Ngondo dey ditamin dis festiva. Ngongo na di politika bodi wey dey kontro di land of Kameroon. Wen di Ngongo don tok sey festiva for Jengu go hapun, Jengu Babalawo ( priest) go start to do sakrifies in di vilejis.