Jump to content

Janet Okala

From Wikipedia

Janet Okala (1894–1971) na Naija politikal lida and komuniti oganaiza. Shi lid wumen protest durin Aba Women’s War, and shi form lokal and nashonal oganaizeshons wey dey fait for Naija wumen politikal pawa.

Hau shi tek stat laif

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Janet Okala for Onitsha for 1894. Shi bi third pikin and fest gel-pikin of Odukwe Odili.[1] Leta shi muv go Owerrinta wie pipul sabi ha wel wel for ha politikal wok.[2] Dem dey kol ha "Mama Bread" bikos shi get bakery biznes.

Hau shi tek du politis and fait for pipul raits

[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1929, durin di Aba Women’s War, Okala lid wumen protest for Owerrinta rijon.

Nina Emma Mba wey bui pesin wey dey rait histri tok say bifor di war, Okala don olredi dey advais and lid lokal wumen, bot durin di war shi kom popula wel.[3]

For 1945, Okala form Enugu Women’s Association and dem elekt ha as one of di vice presidents.[4]

Afta Funmilayo Ransome-Kuti (FRK) visit dem for 1949, di grup chenj nem to Enugu branch of Nigerian Women’s Union.[5]

Okala tok say: "Bifor dat taim, wumen for Enugu no get rait to ask abaut hau dia Kontri dey ron. Wen Mrs. Kuti kom, shi tich os wel."

Lokal newspapers laik West African Pilot and Daily Times praise di nem chenj as sain say Naija wumen dey united for nashonalist strogul.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]
  1. "Okala, Janet". Dictionary of African Biography - Okala, Janet (1894). Oxford University Press. January 2011. ISBN 978-0-19-538207-5.
  2. Chuku, Gloria (2005). Igbo Women and Economic Transformation in Southeastern Nigeria, 1900–1960. Psychology Press. ISBN 978-0-415-97210-9.
  3. Egbo, Benedicta (2000-01-01). Gender, Literacy, and Life Chances in Sub-Saharan Africa. Multilingual Matters. ISBN 978-1-85359-464-9.
  4. Johnson-Odim, Cheryl; Mba, Nina Emma (1997). For Women and the Nation: Funmilayo Ransome-Kuti of Nigeria. University of Illinois Press. ISBN 978-0-252-06613-9.
  5. Ako-Nai, Ronke Iyabowale (2013). Gender and Power Relations in Nigeria. Rowman & Littlefield. ISBN 978-0-7391-7778-5.