Jane Igharo
Jane Abeiyuwa Igharo na Naija fiction raita wey dey rait contemporary romans novels. Shi get plenti fame bikos of ha first novel, Ties That Tether.
Early Life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Jane Igharo for Nigeria, ha pikin na fom Edo State. Shi gro for Nigeria bifor shi an ha famili waka go Canada wen shi dey twelve. Shi leta go University of Toronto to stodi Journalism, an afta shi finish, shi stat wok as communication specialist for Ontario, Canada.
As pikin of pesin wey jos kom fom anoda kontri, Jane tok sey ha famili get big hopes for ha. Her mama tel am sey shi no fit date or mari pesin wey no kom fom ha own plez, so dia kolsho go stil dey kontinue evun dem dey for western wod. Dis idea hep shape di stori for ha first novel.
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ha first novel, Ties That Tether, na stori wey shi rait based on ha pasonal life an immigrant experience. Na Berkley poblish di buk on 29 September 2020, an e get gud feedback fom critics an readers. Ha sekond novel, The Sweetest Remedy, also poblished in September 2021, na anoda success an e get gud reviews.
Ha third novel, Wia We End & Begin, wey e poblish in 2022 an dem pick as an Amazon Editor’s Pick.
Bibliography
[chenj-am | chenj-am for orijin].Ties That Tether – Berkley (29 September 2020)
.The Sweetest Remedy – Berkley (28 September 2021)
.Where We End & Begin – Berkley (27 September 2022)
.Sisi Americanah (coming soon, 2023)