Jump to content

Jadesola Osiberu

From Wikipedia

Jadesola Osiberu Jádesola Osiberu na Nigerian Raita, diarekto an fim produsa wey stat ha own fim kompini wey dem kol Greoh Studios. Shi don popula for fims lik Isoken (2017), Sugar Rush (2019), Brotherhood (2022) an Gangs of Lagos—na di first Nigerian fim wey go sho onli for Amazon Prime Video. For September 2022, Osiberu kompani, Greoh Studios, sign three-year contract wit Amazon to create an produs original TV shos an long fims.

Earli Life an School

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for royal famili for 1985. Ha papa, Oba Adewale Osiberu, na king for Epe Sagamu. Osiberu do ha sekondri skul for Ibadan, shi kon go University of Manchester for UK go stodi Computer Systems Engineering. She stil go Pan-Atlantic University wey dey Nigeria, wia shi stodi Media an Communications.

Even afta shi first wok as software developer, Osiberu leta chenj ha mind go fim-making. To celebrate Women’s History Month, Pulse put ha nem for list of ten wumen wey dey do big tins for Nigerian fim industry. Shi stat ha first fim company, Tribe85 Productions, for 2017. The reason wai shi stat am na bikos shi wan tel Afrika stories wey pipu fom all ova di wod fit enjoi.

For one intaview wey shi do wit BellaNaija, di pesin wey tok to ha praise ha sey shi dey wok hard, shi dey luk smol-smol details, an shi sabi kom up wit beta ideas.

For 2018, shi be big pesin for Nollywood Fim Festival wey dem do for Scotland.

For 2017, shi rait an dairet fim wey dem kol Isoken. Di fim tok abaut di wahala wey wumen wey neva mari dey fez—espeshially wen famili dey pressure dem—an also tok abaut lov insaid black wuman an white man for modern Nigeria. Bikos of di way shi dairet di fim, shi win Best Dairekto for Africa Magic Viewers’ Choice Awards for 2018, an dem stil nominate her for Africa Movie Academy Award.

Isoken no jos be ordinary fim—scholars even uze di fim tok abaut feminism. One media kompini wey dem kol Culture Custodian evun tok sey di fim fight against na whmen society dey treat wumen enihow wey ful for Nigeria.

Ha latest fim Christmas in Lagos go sho for Amazon Prime Video starting from 20 December 2024.

Osiberu do ha wedding for 11 May 2019 for Sagamu, Ogun State.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]