Iyanla Vanzant
Iyanla Vanzant (wey dem bon as Rhonda Eva Harris for September 13, 1953) na Amerika wuman wey sabi tok wel, shi bi lorya, shi sabi tich abaut spirit laife, shi dey rait buk, shi bi life coach, an shi dey do TV show. Pipu sabi am wel bikos of ha buks, ha own tok sho, an di taimes wey shi don sho for di Oprah Winfrey Show. Fom 2012 go rish 2021, na shi bi di host of Iyanla: Fix My Life for OWN TV.
Life an wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Iyanla Vanzant land for dis wod on September 13, 1953, insaide taxi for Brooklyn, New York. Ha papa na Horace Harris, an ha mama wey bi Sarah Jefferson na pesin wey dey wok for train. But wen shi bi jost two years old, ha mama die bikos of breast cancer, so na ha papa pipu kom raise her.
Wen shi mari first time, ha hosband dey beat am, so shi waka komot for the marej in 1980 with her three pikin. For 1983, dem give ha di nem Iyanla, wey mean "Big Mama", afta dem du som tradishonal Yoruba rites for ha.
Shi go school for Medgar Evers College an Virginia Union University. Shi get lor digre fom City University of New York School of Law, an shi get master's digre for spiritual psychology fom University of Santa Monica. Shi don liv for Upper Marlboro, Maryland, an shi stil bi ordained minista for New Thought movement.
For 2000, Ebony magazine put her name for list of "100 Most Influential Black Americans," say shi bi big wuman wey dey hep pipu understand relationship mata. For 2012, Watkins’ Mind Body Spirit magazine put her for number 7 for list of "100 Most Spiritually Influential People."
She don follow Oprah Winfrey do big tok sho tour, an for 2016, Oprah stil put ha nem for list of SuperSoul100 Visionaries & Leaders.
Iyanla be honorary member for Alpha Kappa Alpha sorority. But sie don fez plenti loss for ha life—ha 30-year-old pikin, Gemmia, die for 2003 because of colon cancer. For July 30, 2023, shi anouz sey ha last bon, Nisa, don die too. Shi an her husband, Yemi, separate for 2007.
Buks & TV shos
[chenj-am | chenj-am for orijin]Iyanla don write plenty books wey dey hep pipul find peace, grow their mind, and understand life well. Some of her popular books na:
.Yesterday, I Cried
.Acts of Faith
.Faith in the Valley
.One Day My Soul Just Opened Up
.In the Meantime
.Peace from Broken Pieces
For TV, she don do plenty programs, like:
.Iyanla (2001–2002)
.Starting Over (2004–2006)
.Iyanla, Fix My Life (2012–2021)
She don appear for The Oprah Winfrey Show pas 20 times
She stil don sho for oda TV programs like Moesha, The Dr. Oz Show, Greenleaf, and Braxton Family Values.
Wetin we fit len from Iyanla life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Iyanla laif na example of pesin wey don ci hardship but stil rise. Shi don lose marej, lose pikin, and struggle for laif, but shi use her experience hep oda pipu. She dey tich sey mek we face our past, forgive ourselves, an find way to gro.
Na why plenti pipul dey respect her an read her buks, bikos shi dey tok fom ha heart an fom ha experience.