Jump to content

Iyami Aje

From Wikipedia

Iyami Aje na one yoruba word wey di yoruba pipo-dem dey yuz tok about Afrika wuman wey dem kosida as Aje (witch). Aje na wuman wey no some sikrit about human-bein, wey sabi black pawa (juju) an wey fit mek supa-nashora to hapun.

Orijin of di nem

[chenj-am | chenj-am for orijin]

In yoruba langwej, Iya mi mins my mama. In yoruba tradishonal tori about orijin of life, eni wuman wey bon pikin don bikom a god. Di yoruba risin sey na mama dey bring pikin mom dis life, na mama dey mek suo sey notin do di pikin as im dey gro-up. Bikos of dis, iya mi fit still mins supa-pawaful ones. Di word Aje" get difren minin in yoruba land. Aje fit mins a Afrika wuman wey get di pawa to kill, to helep, to mek someone wey sik dey ok, an to empawa some to faze eni-tin. for one buk wey teresa n. washington rait wey e kol di tahitu in the architects of existence: aje in yoruba cosmology, ontology, and orature, e tok sey no english word go fit rili give di minin of aje. washington kontiniu sey, english word wey fit near di minin of aje smol na pawa , kreashon, supa na

How di tori bi

[chenj-am | chenj-am for orijin]

In Yoruba tradishonal rilijion tori, Orisha Odú is di fonda an di meka of di wold. Wen one yoruba pesin Samuel M. Opeola wey sabi Yoruba rilijion dey tok di tori, e sey, Àjé bi di Odú. . Di word Aje" get difren minin in yoruba land. Aje fit mins a Afrika wuman wey get di pawa to kill, to helep, to mek someone wey sik dey ok, an to empawa some to faze

Meni pipo get difren nem wey dem tek dey praize dia supa-nashoral mama. Some of dem na:

  • Iyami Osoronga
  • Awon Iya wa (our mama
  • Eleye (Owna of di holi bird)
  • Iyanla (Big Mama)
  • Awon Agbalagba (Di mama-dem wey get sense pass an pawa)
  • Gods of di Sosa-e-ti
  • Ayé (dis wold)
  • Yewájobí (Di mama of all di gods an all di tins wey get life)