Jump to content

Isio Wanogho

From Wikipedia

Isio Wanogho (wey dem bon on November 17, 1983) na Nigerian supamodel, pesin wey dey rait for niuzpepa , artist wey sabi paint, an person wey sabi design hauz an room for insaide . Shi start modeling wok in 2002.

Wanogho na Naija pikin. Shi go Mayflower School, wia shi do ha primary an sekondri edukeshon. Afta dat one, shi waka go Paris, France, wia shi stodi Interior Design rish di level of M.Sc. For 2008, Wanogho stil go University of Dundee, wia shi get B.A for Painting an shi len how to draw, paint an do art with ha hand. Yoruba kolsho na wetin inspire ha art wok.


How shi tek stat ha wok

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na one pesin wey dey find models, wey im nem na Otu Winpana, ci Wanogho wen shi dey go hauz fom private lesson. Shi leta join one beauty competishon for 2002 wey dem kol QueenAfrik beauty pageant, an shi rish final level for di contest. For 2015, dem chuz Wanogho as DIESEL campaign ambassador, an shi kom stil be di fez of kompini.

Shi stat to dey present for TV fom 2006. By 2009, shi don bi presenta for one fashion TV station wey be part of Soundcity, wey dem kol Spice TV. For 2012, shi stat ha own kompini wey shi nem Isio De-laVega Design Studios (IDDS). Wanogho don win plenti awods lik:

.2010 FAB Awards – Best Presenter

.2010 African Youth Society – Role Model Award

.2010 NMAA – Best Model-Presenter Award


For 2014, she akt for Ndani TV shows wey dem dey kol Gidi Up an Badt Guy.

Awards and Nominations

[chenj-am | chenj-am for orijin]

.2011: African Youth Society – Honorary Achievement Award and African Role Model

.2010: FAB International Magazine – Model of the Year

.2010: Nigerian Model Achievers Award – Best TV Presenter

.2009: The Future Awards Africa – Model of the Year Finalist

.2010: The Future Awards – TV Presenter of the Year (Nominee)

.2009: Exquisite Magazine – Finalist for Female TV Presenter of the Year

.2017: YNaija/Leading Ladies Africa – One of the 100 Most Inspiring Women for Naija

Wia dem gada tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]