Ire Aderinokun
Ire Aderinokun na Naija wuman wey sabi front-end divelopmet (di part of website wey pipul dey si and yus) and im hosband bi Google Developer Expert.[1][2][3] Shi na di fest Naija wuman wey Google don rekognaiz as Divelopa Ekspat.[4][5][6][7]
Ire life and skul
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ire kom from Ogun Stet, for Naija. Ire papa nem na Tayo Aderinokun an im mama na Olunfunlola Aderinokun.[8]
Afta shi finish sekondri skul for Naija, shi travul go UK go du Bachelor degree for Experimental Psychology for University of Bristol. As shi dey do her Master degree for Law for di sem yunivasiti, na dia ha eye bigin dey opun for komputa sayens. Shi kon rejista for dizain kos for Codecademy - one online place wey dey tich pipul hau to du website and tek tins.[9][10]
Ire na self-taught front-end divelopa - dat one min say shi tich hasef hau to do website and hau to dizain am. Shi build ha first website wen shi bi 13 yias old. Di website na fansite for one online game wey dem dey kol Neopets. Na for dia she fes len hau to rait basic HTML code.[11]
Ire get one blog wey shi dey run - bitsofcode - wia im dey yuz explain tek and coding tips in simple way so oda pipul fit understand am. Shi stat dat blog for 2015.[12]
How im tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ire bi Google Developer Expert, and im sabi HTML, CSS, and JavaScript wel wel - na dem bi di main tuls wey pipul dey yus du di luk and fil of website.
Ire dey also rait atikul for TechCabal, one Naija website wey dey tok tek mata.[13]
Shi help oganaiz Frontstack, one big konfrens wey gada front-end enginias for Naija to len and share ideas. Shi also stat one smol skolaship program wey dey help Naija wuman wey wan enta tek - di skolaship dey help dem go du Udacity Nanodegree (na shot tek course wey dey tich pesin serious skil).[14]
Shi bi co-founder, COO (Chief Operating Officer) and VP Engineering for one kompani wey dem dey kol Helicarrier – na dem dey build cryptocurrency tuls for Africa - dat one min say dem dey wok on hau moni go dey muv izi for internet.[15]
Ire Aderinokun na one of di faundin membas of Feminist Coalition - na grup of yong Naija wuman wey wan si say wuman get di same chans for society, laik hau man dey get.[16]
Wia dem gada di tori
[chenj-am | chenj-am for orijin]- ↑ "Ire Aderinokun: The Inspiring Tech Queen". The Guardian Nigeria News - Nigeria and World News. 2018-03-19. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ BellaNaija.com (2020-02-24). "These 5 Nigerian Women Are Crushing It in the Tech Space". BellaNaija. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ BellaNaija.com (2019-03-28). "From Software Engineers to Venture Capitalists & Policy Makers! These Tech Women had the AUDACITY to Pursue their Big Dreams". BellaNaija. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Ire Aderinokun Is The First Nigerian Woman To Become Google Developer Expert". Women Africa (in Amẹ́ríka Ínglish). 2019-04-09. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ Ajiboye, Tolu (2017-08-14). "Breaking the code: how women in Nigeria are changing the face of tech". The Guardian. ISSN 0261-3077. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "17 powerful women who have shaped Nigerian culture". www.pulse.ng (in Amẹ́ríka Ínglish). 2019-03-06. Archived from the original on 2020-04-07. Retrieved 2020-03-12.
- ↑ "Girl power in a tech world". The Africa Report.com. 2018-10-02. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Ire Aderinokun Is The First Nigerian Woman To Become Google Developer Expert". Women Africa. 2019-04-09. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Women in Tech: Ire Aderinokun". townhall.hashnode.com. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Meet Ire Aderinokun, Nigeria's first female Google Developer Expert". Grafrica. 2017-03-05. Archived from the original on 2021-12-04. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ forcreativegirls_ (2016-09-13). "Women In UX Design: Ire Aderinokun on the Illimitable World of a Developer". For Creative Girls. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Tech Women Lagos". Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Ire Aderinokun". TechCabal. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Story of Ire Aderinokun - Enabling knowledge for all". Udacity. 2019-07-23. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Ire Aderinokun". ireaderinokun.com. Retrieved 2025-04-20.
- ↑ "Feminist Coalition". Elle. Retrieved 20 April 2025.