Ijem Onwuamaegbu

From Wikipedia

Justice Ijem Onwuamaegbu (dem bon am for 1954) na Naijá loya wey bi di fest wuman to bi di oga kpata-kpata for kot for Anambra State. Dem kom stil mek am di chairman for Anambra State Law Revision Commrittee for December 13, 2018. E finish skul for University of Nigeria for 1977 an dey kol am go Naijá bar for July 7, 1978. Dem put am as di oga kpata-kpata for kot for Anambra State Highcourt of Justice for May 8, 2001. Ijem wok for National Assembly/Governorship/Legislative Houses Election Petition in Nasarawa stet and Ondo stet for 2007 an 2008. Dem put Justice Onwuamaegbu as di pesin wey go dey wok as di oga kpata-kpata for kot mata inside Anambra State for March 1, 2019 an dey kom mek am di oga kpata-kpata for kot mata inside Anambra State for August 2019 an dat one mek am di fest wuman to get dis wok for Anambra State. Ijem finish di wok for September 3, 2019 as shi rish di nomba of years wey pesin sopoz rish bifor pesin stop to wok wey bi 65 years.