Jump to content

Ifi Amadiume

From Wikipedia

Ifi Amadiume wey dem bon on April 23, 1947. Shi bi Naija pesin wey dey rait poem, pesin wey dey stodi how pipu dey liv, dia kolsho an society, an pesin wey dey rait long artiku or rait-up. For 1993, wen shi rish 46 years, shi join Religion Department for Dartmouth College, wey dey New Hampshire, USA. Hol ha laife, shi don rait an kontribute join 13 buks and pepas.

Ha life stori

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for Kaduna an ha papa an mama na Igbo. Na for Nigeria shi go skul bifor shi waka go Britain for 1971. For dia shi go Skul of Oriental an African Studies for University of London. Shi kolet BA for 1978 and PhD for 1983 for social anthropology. Dis course na di one wey dey stodi pipu life, kolsho an soshial behaviour. Shi len Hausa lagwej for dia.

Shi wok as risach felo for one year for University of Nigeria, Enugu, an shi don tich for UK, Canada, USA an Senegal. For July 2000, shi bi full profesor for Religion an shi stil dey tich African American Study courses.

Ha risach for Africa mek two crious buks kom out wey tok abaut Igbo kolsho: African Matriarchal Foundations (1987) an Male Daughters, Female Hosbands (Zed Press, 1987). Di sekond buk na big deal bikos e kom bifor pipu stat dey tok abaut stodi of gender an sexuality wey no folo norma way pipu dey luk am. Di buk tok sey for Afrika bifor oyinbo colonization, di way pipu tek dey ci man or woman no be lik how Western pipu tek dey ci am as onli two types.

Anoda buk wey shi rait, Reinventing Africa, kom out for 1998. Pat of ha wok dey insaide one big poetry collection wey dem kol Daughters of Africa (1992).

As pesin wey dey rait poem

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi folo go Festac '77, wey bi Second World Black an African Festival of Arts an Culture. Ha poem collection Passion Waves (1985) almost win Commonwealth Poetry Prize. Shi leta win Flora Nwapa Society Award for her 2006 poetry buk Circles of Love.

Shi dey advisory board for one grup wey dem dey kol Centre for Democracy and Development (CDD). Dis grup na NGO wey dey promote democracy, peace an human rights for Africa, especially for West Africa.

Pipu sabi an respet Amadiume bikos of ha strong wok for wumen rights an gender tok. Ha wok hep pipu stat to dey think niu way abaut gender, pawa, an wumen rol for society an histri. But som pipu don stil dey tok bad abaut ha bikos dem feel say shi dey holways tok sey wuman no dey peaceful an loving, an dem no gree wit dat kaind idea.

Poems

.Passion Waves, London: Karnak House, 1985

.Ecstasy, Longman Nigeria, 1995

.Returning .Circles of Love, Africa World Press, 2006

.Voices Draped in Black, Africa World Press, 2008

.Contributor for Poems for a Century: An Anthology on Nigeria, Amalion Publishing, 2014

.Anthropology

.African Matriarchal Foundations: The Igbo Case, London: Karnak House, 1987

.Male Daughters, Female Husbands: Gender and Sex in an African Society, London: Zed Press, 1987

.Re-inventing Africa: Matriarchy, Religion and Culture, Interlink Publishing Group, 1997

.The Politics of Memory: Truth, Healing, and Social Justice (with Abdullahi A. An-Na’im), Zed Books, 2000

.Daughters of the Goddess, Daughters of Imperialism: African Women Struggle for Culture, Power and Democracy, Zed Books, 2000

.Contributor for Chinua Achebe and the Igbo-African Between Fiction, Fact, and Historical Representation, Lexington Books, 2022

.African Possibilities: A Matriarchitarian Perspective for Social Justice, Zed Books 2024.

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]