Ifeoma Onyefulu
Ifeoma Onyefulu (dem bon am for 1959) na Naija wuman wey dey rait buk for pikin, shi bi novel raita an shi sabi tek foto wel-wel. Pipu sabi ha wel wel bikos of di kaind pisho buk wey shi dey do — na ha own foto dem dey sho vilej life for Africa dey insaide di buk.
About ha laif
[chenj-am | chenj-am for orijin]Dem bon Onyefulu for Onitsha, wey be one big town for Anambra State for southeast Nigeria. Shi kom fom Igbo pipu for Nigeria. Na UK shi dey stay nau, but na for Naija shi gro. Shi mari, kom waka go Britain for 1982. For dia, shi go one skul wey dey tich how to tek pisho for Earls Court. Shi stop di biznes wey shi dey du bifor, bikos shi don lik photography wel-wel for dia. Shi stat to dey tek foto for niuzpepa. Fom 1986 go 1987, shi wok for one niuzpepa.wey dem dey kol Caribbean Times as photographer.
For 1991, shi stat to dey rait join foto wey shi dey tek. Shi get two pikin, an na bikos of dem shi stat to rait buk wey chudren go fit read. Wetin shinci wit her pikin an how dem tek go skul mek ha stat reson thins wey concern chudren pas.
Awod
[chenj-am | chenj-am for orijin]Ha first buk A is for Africa na one of di best buks for pikin dem wey dem chuz for Child Education and Junior Education.
Shi don win The Children's Africana Book Awod two tiames: one for Here Comes Our Bride! for 2004 an anoda one for Ikenna Goes to Nigeria for 2007. Shi stil win Best Book for Young Children for America for 2005 for Here Comes Our Bride! and for Ikenna Goes to Nigeria for 2008.
Buks wey shi don rait
[chenj-am | chenj-am for orijin].A Is for Africa: An Alphabet in Words and Pictures – 1993
.Emeka's Gift: An African Counting Story – 1995
.Ogbo: Sharing Life in an African Village – 1996 (for London dem poblish am again as One Big Family)
.Chidi Only Likes Blue: An African Book of Colors – 1997
.Grandfather's Work: A Traditional Healer in Nigeria – 1998 (for London, dem call am My Grandfather Is a Magician)
.Ebele's Favourite: A Book of African Games – 1999 .A Triangle for Adaora: An African Book of Shapes – 2000
.Saying Goodbye: A Special Farewell to Mama Nkwelle – 2001
.Welcome Dede!: An African Naming Ceremony – 2003
.Here Comes Our Bride!: An African Wedding Story – 2004
.An African Christmas – 2005
.Ikenna Goes to Nigeria – 2007
.Grandma Comes to Stay – 2010
.New Shoes for Helen – 2011
.Omer's Favorite Place – 2011
.The Girl Who Married a Ghost: and Other Tales from Nigeria – 2012
.Look at This!: Clothes – 2013
.Look at This!: Food – 2013
.Look at This!: Home – 2013
.Look at This!: Play – 2013
.Vicky Goes to the Doctor – 2014