Jump to content

Ifeoma Okoye

From Wikipedia

Ifeoma Mokwugo Okoye dem bon for 21st December (e fit b 1937), na Nigerian wuman wey sabi rait buk. Pipu wey sabi am dey kol am “di most important wuman raita wey kom fom Nigeria afta Flora Nwapa an Buchi Emecheta,” na wetin Oyekan Owomoyela tok. Shi kom fom Anambra State wey dey Eastern Region of Nigeria. Shi go St. Monica’s College for Ogbunike, an na for dia shi kolet ha tiching certificate for 1959. Leta, shi go University of Nigeria for Nsukka wia shi stodi English an graduate with Bachelor of Arts honors digre for 1977. Shi rait plenti buks, som na for chudren, lik The Village Boy an Eme Goes to School, an shi stil rait adult novel lik Behind the Clouds.

How shi gro an skul

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ifeoma Okoye na wuman wey dem bon for 21st December, an e fit be say na for 1937. Shi kom fom Anambra State for Nigeria. Shi go Monica’s College for Ogbunike, an na dia shi get certificate to bi ticha. Afta dat One, shi tich for di sem skul for two years. Insaid 1963 an 1967, shi go All Saints International School for Enugu. Fom 1971 rish 1974, shi run ha own nursery skul for Enugu. Fom 1974 to 1977, shi go University of Nigeria for Nsukka, wia shi stodi English an graduate. From 1986 to 1987, shi travu go Aston University for England go do more stodi, an shi get postgraduate digre for English. Afta dat, shi tich English for Nnamdi Azikiwe University rish year 2000.

Wetin shi don achieve

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Plenti pipu sabi ha wel wel for ha children stories, Ifeoma stil rait buk wey big pipu fit rid, lik Behind the Clouds. Dis buk tok abaut hosband an waife wey no get pikin, an how pipu holways blame di wuman instead of di man.

Shi win awod for both Behind the Clouds an The Village Boy fom Nigerian National Council of Art an Culture for 1983. Shi stil win “best fiction of the year” awod for ha buk Men Without Ears for 1984. For 1985, shi kolet anoda awod for Only Bread for Eze for Ife National Book Fair. Shi stil win African Regional Winner for Commonwealth Short Story Competition for 1999.

Di main buk wey shi rait

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Afta shi don go skul finish, na dat taime shi stat to rait full taime. Shi rait meni shot stories an novels. Most of ha buks na for children, but shi stil rait som for adults.

Som of her buks

.GO FOR GOLD With Your Writing: A Practical Self-Guide To Writing Gold-Winning Sentences (2016)

.The Fourth World (2013)

.The Power of a Plate of Rice (about 2011)

.The Trial and Other Stories (2005)

.Ayo and His Pencil (1995)

.Neka Goes to Market (1995)

.Chika’s House (1995)

.Chimere (1992)

.Men Without Ears (1984)

.Behind the Clouds (1982)

.Village Boy! (1986)

.Adventures of Tulu, the Little Monkey (1980)

.Busy Bee Number Workbook (1980)

.Only Bread for Eze (1980)

.Emeka Goes to School (1979)

Wia dem gada di tori

[chenj-am | chenj-am for orijin]