Ifeoma Aggrey-Fynn
Ifeoma Iphie Aggrey-Fynn (dem bon on 8 June 1980 – e kpai on 2 June 2015), wey plenty pipul sabi as Iphie, na Ghana-Nigeria media pesin, shi bi raita an poblik spika.
Earli Life an Edukeshon
[chenj-am | chenj-am for orijin]Aggrey-Fynn papa na Ghana man an ha mama na Nigeria wuman. Na for Nigeria shi gro an na dia shi go skul. Shi go Abia State University, wia shi stodi Linguistics an Communication, an na dat course shi graduate fom.
Wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Aggrey-Fynn stat ha wok for media as TV presenta for 2003. For 2009, shi join Silverbird Communications, an dey leta kari ha go wok for Rhythm 95.7 FM an Silverbird Television for Awka. For dia, shi dey du redio an TV programme lik; Rhythm & Soul, Gospel Vibes and E-Merge. Later, dem kari ha go Rhythm 93.7 FM for Port Harcourt.
Na shi host Miss Niger Delta beauty contest three taimes. Ha shos dey hep pipu wey dey fez wahala for laife mek dem fit get beta way to handu am.
How e kpai
[chenj-am | chenj-am for orijin]Aggrey-Fynn go visit ha papa an mama for Aba, wey dey Abia State. As shi dey go bak to Port Harcourt, armed robbers attack di bus wey shi dey insaide. As di driva dey drive, di armed men stat to shoot di motor. Bullets touch Aggrey-Fynn an shi kpai fom di injuri.
Anoda stori tok sey na ha boyfrend dey drive her go house on 2 June 2015. Shi go Aba to ci ha papa, mama an oda famili memba. As dem rish hauz area, armed men kom blok dem. As the guy try run, dem begin shoot. Di gunshot hapun 7:00 evening near wia Aggrey-Fynn dey sta. Di armed men kari ha boyfrend go, but shi fall for ground dey bleed. Neighbours wey sabi ha rosh kari ha go hospital, but wen dem rish, dokto tok say shi don kpai.