Jump to content

Idoma People

From Wikipedia
Idoma People
ethnic group
Subclass ofVolta–Niger peoples Chenj-am
KontriNaija Chenj-am
Language usedIdoma langwej Chenj-am

Idoma pipo na pipo wey plenti wel wel for Benue Stet, Naija. Some Idoma pipo dey live for Taraba Stet, Kross Rivas, Enugu Stet, Kogi Stet, an Nasarawa Stet.


Di Idoma langwej dey inside di Akweya subgroup of di Idomoid langwej of di Volta- Niger famili wey inklude: Igede, Alago, Agatu, Etulo, Ete, Akweya (Akpa), an Yala langwej of Benue, Nasarawa, Kogi, Enugu, an Norta Kross Rivas Stet. Di Akweye group is klose to Yatye-Akpa Subgroup. Dia mejo land de inland teriteri wey bi south of riva Benue. Pesin go find am if pesin go Seventy-two kilomitas east of confluence with Rivas Niger. Pipo sabi di Idoma pipo as woriho an huntas. Dey no Dem as pipo wey sabi welcome odas an wey love peace. Bikos pipo no tu sabi di land wey di Idoma pipo dey live ontil 1920s, dem no fit tempa with dia tradishon.Dis one mek dia kolsho an tradishon stil remain . Di pipo of Idoma go rish 3.5 million. Dia tradishonal rula nem na Och'Idoma. Na Och'Idoma bi di head of di Idoma Aria Tradishonal Kansu