Idan
Hau e go bi
Idan na one yoruba word wey di mini na majik[1]. Wen pipo for strit yuz di word Idan for pesin, dis one fit mins sey di pesin get sense wel wel[2].
On May 14, 2023, Bola Ahmed Tinubu wey bi di pesin wey Naija pipo selet to bi dia presido in di 2023 presidenta eleshon yuz di word Idan to diskrib Hilda Baci[3]. Hilda Baci na one Naija ledi wey enta di Guiness book record as di pesin wey fit yuz plenti hours to cook food without restin.[4]
- ↑ https://tribuneonlineng.com/idan-all-you-need-to-know-about-trending-nigerian-street-slang/
- ↑ https://punchng.com/things-you-dont-know-about-idan/
- ↑ https://dailypost.ng/2023/05/14/idan-doesnt-break-tinubu-hails-chef-on-mission-to-break-guinness-world-record/
- ↑ https://guardian.ng/news/hilda-baci-nigerian-chef-sets-100hrs-new-world-record-for-longest-time-in-cooking-marathon/