Ibiyemi Olatunji-Bello

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Professor Ibiyemi Olatunji-Bello (Dem bon am for April 23, 1964) na Naija pesin wey bi professor of filosofi an di 9th Vice Chancellor of Lagos State University(LASU).

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Ibiyemi Olatunji-Bello for Lagos on April 23, 1964. E go Anglican Girl Grammar School Surulere an Methodist Girls High School for Yaba for e sekondiri skul edukeshion.Bello leta go Lagos State College of Science and Technology an University of Ibadan wie e kolet But Bachelors digri for filosofi for 1985. Bello stil du e Masta for filosofi for University of Lagos for 1987. E stil go University of Texas, Health Science Center, San Antonio fom 1994 go rish 1998.

Bello leta saf as assistant leshura for College of Medicine University of Lagos and e kwik kwik gro kom bikom professor of Filosofi for Lagos State University College of Medicine for 2007.E kom stil saf as di deputy Vice Chancellor of LASU for 2008.Bello stil saf as di aktin Vice Chancellor of LASU bifo dem kom appoint am as Vice Chancellor.

Na di Lagos State Komishional for Environment and Water Resources wey e nem bi Olatunji Bello na e mari an na 3 pikin e bon