Hope Uzodima
Hope Odidika Uzodimma (dem bon am on 12 December 1958) na Naija politishan wey don dey searf Govnor of Imo State sins 2020.
For 14 January 2020, Supreme Court of Nigeria tok sey Uzodimma, wey be membea of All Progressives Congress (APC), win di 2019 Imo governorship eleshon. Dem kansu di eleshn wey bifor bifor govnor, Emeka Ihedioha, fest win.
Wia e stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Hope Uzodimma wey dem bon for 12 December 1958 for Omuma, insaid Igbo Catholic famili. Im papa, Chief Michael Uzodimma, na Igwe of Ozuh Omuma, and im mama na Ezinne Rose Uzodimma (née Nneoha).
Im famili to Okoro family of Etiti-Omuma. Uzodimma na strong Catholic, and e mari Chioma Uzodimma, dem get seven pikin.
Uzodimma go Mgbidi Secondary School for Omumu, Oru West, Imo State.
For 1978, e enta college go stodi international studies till 1982 wene finish im bachelor’s digre. Bifor dat taim, e don get one advans diploma for transport stodies.
For May 2024, dem giv am di 52nd Convocation Lecture for University of Nigeria, Nsukka.
For December 2024, Federal University of Technology, Owerri (FUTO) giv am Honorary Doctorate in Management bikos of di wok wey e don do for national development and how e dey sopot di university.
How e stat politis wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]For 1990s, during the wahala transition to Third Nigerian Republic, e join United Nigeria Congress Party.
Afta democracy kim bak for 1999, e join Peoples Democratic Party (PDP).
Insaid 1999–2017, e sarf for meni ples for PDP — lik National Caucus, National Executive Committee, and Board of Trustees.
Uzodimma na klos frend to Governor Achike Udenwa til 2002 wen e waka go Alliance for Democracy (AD) go contest for govnor for 2003 eleshon.
E luz, and for February 2004, e kom PDP bak.
For December 2006, e kontest PDP governorship primari na im bi second afta Senator Ifeanyi Araraume.
For 2011, wen Govnor Ikedi Ohakim join PDP, Uzodimma sopot am to run again, instead of Rochas Okorocha (wey leta win).
For January 2011, Uzodimma win PDP senatorial primari for Imo West wit 2,147 votes. But one Federal High Court tok say e no qualify bikos PDP electoral panel neva klear am. Court of Appeal put di jorjment on hold, so e stil campaign.
For April 2011 eleshon, e get 85,042 votes, win bifor bifor govnor Achike Udenwa (ACN) and Rajis Okpalan Benedicta (APGA). Leta, Supreme Court tok say Uzodimma na di koret candidate and na e win.
Senate (2011–2019)
.For 6 June 2011, dem swear Uzodimma in as Senator for Imo West.
.For 2015, e win second term.
For 2018, e komot PDP join APC to kontest for Imo govnorship eleshon 2019.
Governor of Imo State
For March 2019, INEC anous results:
Emeka Ihedioha (PDP) – 273,404 votes
Uche Nwosu (Action Alliance) – 190,364
Ifeanyi Ararume (APGA) – 114,676
Uzodimma (APC) – 96,458 (4th place)
Uzodimma no gree, e kari di mata rish Supreme Court. For 14 January 2020, Supreme Court tok say 388 polling units wey giv Uzodimma/APC votes no dey insaid bifor, and wen dem add am, Uzodimma get majority of koret votes, so na im bi Govnor.
For 15 January 2020, dem swear Uzodimma and Placid Njoku in as Governor and Deputy Governor.
For im first speech, e order:
.Accountant-General must sho full money rekord of Imo State from May 2010 to January 2020
.Permanent Secretaries must sho status of ol govment contracts
.Stop payment for ol ongoing contracts until further instruction.
.For 31 May 2023, Uzodimma bi Chairman of Progressive Governors Forum (PGF). Governor Uba Sani of Kaduna be im vais.
.For August 2023, as eleshon dey kom, e chuz niu running mate: Chinyere Ihuoma Ekomaru.
Awods and Nominashons
[chenj-am | chenj-am for orijin].2017: Nigerian News giv am “Most Outstanding Parliamentarian of di Year – Personal Life Award.”
.2022: United Nations giv am peace awod for promotin peace between different tribes and good governance.
.Nominated by United Towns Agency (UTA) for UN North-South Cooperation.
.The Sun Award 2021 – Govnor of the Year.
.2023: Face of Democracy Nigeria (FDN) giv am Most Prolific Govnor of the Year.
.May 2023: Rivers State give am Grand Service Star of Rivers State (GSSRS) for nashonal unity work.
.ICAN honor am for promoting transparency in govment.
.E stil kolet UN peace awards again.
May 2023: President Muhammadu Buhari give am Commander of the Order of the Niger (CON).
Titles
[chenj-am | chenj-am for orijin]Uzodimma get di ceremonial title Onwa-Netiri Oha of Omuma for Oru East LGA, Imo State.